150
Praiz God 
 
1 Make wi Praiz God!  
Make wi praiz am for en temple;  
make wi praiz am for di sky wey dey tok about en great pawa!   
2 Make wi praiz am for di big-big tins wey E dey do;  
make wi praiz am, bikos en greatness good pass evritin!   
3 Make wi praiz am with trumpet sound;  
make wi praiz am with jita and harp!   
4 Make wi dance praiz am with sheke-sheke;  
make wi praiz am with jita and flute!   
5 Make wi dey nak cymbals togeda as wi dey praiz am.  
Yes! Make wi praiz am with loud cymbals.   
6 Make evritin wey dey alive, sing praiz God.  
Make evribody praiz God!