149
Praiz Song 
 
1 Make wi praiz di Oga wey bi awa God  
kon sing new song to am.  
Make wi sing praiz am  
for where en pipol gada put.   
2 Israel pipol, make una happy bikos of di Pesin wey kreate una.  
Jerusalem pipol, make una praiz God well-well.   
3 Make una dance praiz en name with sheke-sheke and jita,   
4 bikos God like en pipol and doz wey honbol demsef,  
E dey make dem win.   
5 Make doz wey dey fear am, happy, bikos E go fight for dem!  
Make dem shaut for joy as dem dey sleep for dia bed!   
6 As dem hold swod wey get two mout for dia hand,  
make dem praiz God,   
7 so dat dem go fit revensh dia enemies  
kon ponish di strenjas.   
8 Dem tie dia enemies kings with shains  
and dia priests with iron   
9 and dem dey judge dem just as dem rite am.  
God go fight for evribody wey dey serve am!  
So make wi praiz di Oga wey bi awa God!