147
Praiz God Wey Get Pawa 
 
1 Make wi praiz God!  
Si as e dey good to sing praiz God!  
Yes, na to praiz God bi di rite tin to do!   
2 God dey ribuild Jerusalem and E go bring en pipol  
kom back to Israel from di land where dem dey.   
3 E heal pipol wey dia heart don break  
kon trit dia sore.   
4 E dey kount  
and koll di stars by dia names.   
5 Si as awa Oga God big rish!  
En pawa dey wonderful!  
Nobody fit undastand how God take dey know tins!   
6 God dey support pipol wey nor dey karry body up,  
but E dey kill wiked pipol trowey.   
7 So, make una sing tank God;  
make una use harp take sing praiz awa God.   
8 E kover di heavens with kloud kon make rain fall for di eart,  
den E make grass grow on-top mountins.   
9 E dey give food to wild animals  
kon feed di yong birds wen dem dey kry.   
10 E nor kare about di pawa wey horse get  
or di one wey human being get.   
11 No! But God dey happy for pipol wey dey fear and obey am;  
doz wey put dia hope for en love wey nor dey fail.   
12 So, Jerusalem pipol!  
Make una praiz God!  
Pipol for Zion, make una gi-am all di praiz!   
13 Bikos E don make di iron for una gate strong  
kon bless all una shidren.   
14 E send peace kom una land  
kon make una chop betta food.   
15 E send en laws kom di world;  
so make una si as en word kwik kom meet una!   
16 E send snow kom like as wool dey fall;  
E skata snow for groun like ashes.   
17 E trow big-big stones with fire kom di eart.  
So, na who fit stand face God kold breeze  
wey fit turn pesin to ice-blok?   
18 But as E kommand, di kold breeze and ice-blok kon melt.  
E send en breeze and di ice-blok kon turn wota.   
19 E don show Jakob en word,  
kommands and rules for Israel pipol.   
20 E neva do like dis for any oda nashon;  
no oda nashon know en rules and kommand.  
So make wi praiz God!