146
Praiz God Wey Dey Save Us 
 
1 Praiz God!  
My soul, make yu praiz God.   
2 I go praiz God as long as I dey alive.  
Even if I dey die, I go sing praiz to God.   
3 Make yu nor trust pipol wey get pawa;  
bikos dem nor go fit help yu.   
4 Wen dem don die,  
dem go-go back to di groun and all dia plans go die with dem.   
5 But pipol wey Israel God bi dia helpa and hope,  
dey inside di Oga God and na joy dey follow dem.   
6 Na God make heaven and eart, di sea and evritin wey dey inside dem.  
E dey keep all di promise wey E make.   
7 Pipol wey dem dey opress,  
E dey judge dia kase well and dey feed doz wey dey hongry.  
God dey free pipol wey dey prison.   
8 God dey open blind pipol eyes  
kon karry doz wey dey weak, go up.  
God love pipol wey dey fear am.   
9 God dey guide di strenjas among us.  
E dey kare for pipol wey nor get papa and mama  
and wimen wey dia husband don die,  
but E dey ponish wiked pipol with dia wiked plans.   
10 So God go rule forever.  
Jerusalem pipol, E go bi una God  
from one generashon go rish anoda.  
So, make wi praiz awa God!