142
Prayer For Help 
 
David Song Wen E Dey Hide 
 
1 I kry to God!  
I dey beg make E kom help mi.   
2 I tell am all my komplain  
and trobols.   
3 Wen I nor get pawa again,  
na-im dey protet mi as I dey waka.  
Bikos anywhere wey I dey go,  
my enemies don set trap dey wait for mi.   
4 I dey look for di rite pesin wey go kom help mi,  
but nobody dey even tink go my side!  
Nobody to help mi;  
nobody even kare about wetin go happen to mi.   
5 Den I pray to Yu, my Oga God kon sey,  
“Na Yu dey guide mi.  
Na Yu bi evritin wey I really wont for dis life.   
6 Make Yu hear my prayers,  
bikos I don taya.  
Make Yu save mi from pipol wey dey opress mi,  
bikos dem too strong for mi.   
7 Bring mi kom out from prison,  
so dat I go tank Yu.  
Pipol wey dey fear God go kom gada round mi,  
bikos Yu dey good to mi.”