141
Prayer For Evening 
 
David Song 
 
1 My Oga God, I dey koll Yu, so make Yu kwik kom!  
Make Yu listin wen I kry to Yu for help!   
2 Make Yu asept my prayers like incense wey dem offa give Yu  
and di hand wey I take dey praiz Yu,  
asept am like ofrin wey pipol dey give Yu for evening.   
3 My God, make Yu help mi kontrol my mout  
kon guide my lips.   
4 Nor let mi waka enter evil or follow pipol do bad tins.  
Nor let mi chop sweet food wey wiked pipol kook.   
5 Make pipol wey dey fear God beat and korrect mi with love!  
Make my head nor rijet good oil!  
True-true, even with all dia wiked plans,  
my prayers dey make dem fear.   
6 Wen dem trow dia leaders down from rock,  
di pipol go kom listin to my word wey go diliver dem.   
7 Just as pesin dey klear and dig groun,  
na so too wiked pipol bones skata for dia grave mout.   
8 But my Oga God wey get pawa, I dey look up to Yu.  
Na Yu bi my guide; so make Yu nor let dem kill mi.   
9 Make Yu keep mi from di trap wey dem don set for mi;  
di hole wey wiked pipol dig.   
10 Make Yu let wiked pipol fall enter dia own trap  
and free mi from dia trobol.