131
Prayer For Trust 
 
David Song 
 
1 My God, my heart nor dey proud;  
my eyes nor dey look anyhow.  
I nor dey worry mysef with matter  
wey too heavy for mi to bear.   
2 Instead, I dey kwayet and dey silent  
like pikin wey nor dey kry for breast milk again.  
Yes, I kwayet like pikin wey en mama karry.   
3 So Israel pipol, make una put una hope for God hand,  
both naw and forever more!