130
Prayer For Help 
 
Solomon Song 
 
1 My God, I dey kry kom meet Yu  
with pain for my heart.   
2 My Oga God, make Yu listin  
and hear mi as I dey kry for mesi!   
3 If to sey Yu, my God won kount  
all di sins wey pesin kommit,  
den na who go fit stand before Yu?   
4 But Yu always dey ready to forgive so dat dem go honor Yu.   
5 So, I put my hope for God hand,  
I trust am with my whole life  
and I dey wait for en word wey nor dey fail.   
6 Di way I dey find God,  
sirious pass as gateman dey wait make day break.  
Yes o-o, e sirious pass as gateman dey do for morning.   
7 So Israel pipol, make una put una hope for God hand,  
bikos God dey show en love  
and E always dey ready to save en pipol.   
8 E go diliver Israel pipol from di wahala wey dem dey face,  
bikos of dia sins.