127
God Goodness 
 
Solomon Song 
 
1 Unless God build house,  
di pipol wey dey build am,  
just dey waste dia time.  
Unless God guide town,  
doz wey dey guide am, nor go fit protet am.   
2 E dey yuzles to work hard from morning go rish nite,  
bikos of wetin yu go chop.  
Yes! God dey provide for di pipol wey E love,  
even wen dem dey sleep.   
3 Yes! Shidren na God gift;  
dem bi reward from awa Oga God.   
4 Pikin wey yong man born,  
strong like arrow for warrior hand.   
5 Na dem bi di main rizin wey make man dey happy  
and shame nor go katch di man  
even wen e meet en enemies for di town gate.