126
Prayer To Diliver 
 
David Song 
 
1 Wen God take wi en pipol go back to Zion from Babilon,  
E bi like sey wi dey dream!   
2 Wi bigin laf kon dey sing for joy.  
So di oda nashons kon sey,  
“Di Oga God don do good tin for dis pipol o-o.”   
3 Yes, God don do betta tin for us,  
so awa joy don plenty!   
4 Oga God, just as wota dey make dry land fresh,  
na so too Yu go do for us wen Yu give us awa propaty back.   
5 Pipol wey sofa plant dia seed,  
go harvest wetin dem plant with happiness.   
6 Dem dey kry as dem dey go plant dia seed,  
but dem go dey sing with joy as dem dey kom back with wetin dem harvest.