107
God Goodness 
 
1 Make wi tank God,  
bikos E dey good!  
En love wey nor dey fail, dey forever.   
2 Make pipol wey God don save, tok about am.  
Make dem tell odas sey E don save dem from dia enemies.   
3 Bikos E don gada en pipol from many land;  
from east and west, nort and sout,   
4 even doz wey dey waka for di wildaness  
and di ones wey lost and nor get house.   
5 Dem bin dey hongry and wota nor dey to drink  
and some even faint as dem dey waka,   
6 so dem kry as dem dey trobol sey,  
“Awa God, make Yu kom help us!”  
So God save dem from dia trobol.   
7 E take dem go where dem go for dey save;  
di town where dem go stay.   
8 So make dem praiz God,  
bikos of en great love  
and for di wonderful tins wey E don do for dem.   
9 Bikos E dey give wota to pipol wey nid am  
and food to doz wey dey hongry.   
10 Some sidan for where dark pass  
and dem shain dem with iron,   
11 bikos dem go against God word,  
dem nor gri listin to wetin di Most High God tok   
12 and na dis rizin make God ponish dem,  
so dat dem go learn, bikos wen dem fall, nobody dey to help dem.   
13 Wen dem dey trobol,  
dem kon kry sey,  
“Awa Oga God, make Yu kom help us.”  
So God save dem from dia trobol.   
14 E komot dem from di darkness  
kon break di shains.   
15 So make dem praiz God,  
bikos of en great love  
and for di wonderful tins wey E don do for dem,   
16 bikos E break di prison gate wey dem make with bronze  
kon kut all di bars wey dem make with iron.   
17 Bikos some nor get sense,  
dem kon tok against am and dem sofa for dia sins.   
18 Dem nor even fit chop  
and na die remain for dem to die.   
19 Wen dem dey trobol, dem kon kry sey,  
“Awa Oga God, make Yu kom help us.”  
So God save dem from dia trobol.   
20 E send en words kon heal dem  
and E take dem komot from deat hand.   
21 So make dem praiz God,  
bikos of en great love and for di wonderful tins wey E do for dem.   
22 Make dem tank am with sakrifice  
kon sing about di tins wey E do.   
23 Some use ship for sea dey travel  
round di world.   
24 Dem si all di tins wey God dey do;  
all di wonderful works wey E do for di deep sea.   
25 E kommand and breeze raiz-up  
with all di waves for di sea.   
26 Di waves karry di ship up-and-down for di sea  
and doz wey dey drive di ship fear well-well,  
bikos of di great wahala wey di wave dey kause.   
27 So dem kon dey shake and stagga like pesin wey don drink  
and all wetin dem know,  
nor fit help dem.   
28 Wen dem dey trobol, dem kon kry sey,  
“Awa Oga God, make Yu kom help us.”  
So God save dem from dia trobol.   
29 God stop di wave for di sea  
and evriwhere kon kwayet.   
30 Dis kon make doz wey dey drive di ship happy,  
den di wota karry dia ship go rish land!   
31 So make dem praiz God, bikos of en great love and di wonderful tins wey E do for dem.   
32 Make dem praiz am for where pipol dey  
and for where di leaders for di nashon gada put,   
33 bikos E turn river to desert and spring wota to land wey dry well-well.   
34 E turn di land wey get fruit to land wey nor get anytin at-all,  
bikos of di wiked tins wey di pipol wey dey stay der, dey do.   
35 But for en pipol,  
E turn desert to where wota full  
and dry land to where wota dey flow pass,   
36 den E bring doz wey dey hongry make dem  
kon stay and build dia house for der.   
37 Dem plant seeds and vine for di land  
kon harvest plenty fruits and food.   
38 E bless dem, so dat dem go born  
kon plenty for di land and na so too E make dia animals plenty.   
39 But as for dia enemies,  
dem kon dey small more-more,  
bikos of di pain and sofa wey dem dey face.   
40 God nor sorry for dia prince, instead E make dem dey waka for di dry and empty land.   
41 Yet E save poor pipol from doz wey dey opress dem kon make dia family many like plenty animals.   
42 Wen pipol wey dey obey God si all dis tins, dem go happy,  
while wiked pipol go shut up dia mout.   
43 So anybody wey get sense, make e learn from all dis tins  
and tink about how God good rish and en love wey nor dey fail.