106
God Dey Good 
 
1 Make wi praiz God! Make wi tank am, bikos E dey good!  
E love wey nor dey fail, dey forever.   
2 Who fit kount all di wonderful mirakles wey God don do?  
Who go fit praiz am rish?   
3 Joy dey for pipol wey dey do well  
and always dey do wetin dey rite.   
4 My God, wen Yu dey show yor favor to yor pipol,  
make Yu remember mi; make Yu kom near and save mi.   
5 Make I share for di joy wey Yu dey give  
to di pipol wey Yu choose.  
Make I happy, bikos yor pipol dey happy;  
make I praiz Yu with doz wey bi yor own.   
6 Wi don sin like awa grand-grand papa.  
Wi don do plenty bad tins! Wi don do wiked tins well-well!   
7 Awa grand-grand papa dem nor tank Yu for all wetin Yu do for dem for Egypt.  
Dem kwik forget all di good-good tins wey God do for dem.  
True-true, dem go against God kommand, afta dem cross di Red Sea.   
8 But God still save dem,  
just to defend di honor for en name and to show en mighty pawa.   
9 E kommand di Red Sea make e dry  
kon take Israel pipol cross am like sey na desert   
10 and E save dem from dia enemies  
kon diliver dem from pipol wey won kill dem.   
11 Den, di river kover and kill dia enemies  
and no one among di enemies, survive.   
12 So en pipol kon bilive en promise  
and dem kon dey sing and praiz am.   
13 But si as dem kwik forget wetin God do!  
Dem nor gri listin to en advise!   
14 For di desert, dem bigin put eye for bad-bad tins  
kon dey test God patient for dat dry and empty land.   
15 So God give dem wetin dem ask for,  
but E send diziz and wahala follow di tins.   
16 Di pipol for di kamp  
kon dey jealous Moses and Aaron wey bi God priests.   
17 Bikos of dis, di eart open kon swallow Datan,  
Abiram and all doz wey dey support dem.   
18 Fire fall on-top all doz wey dey follow dem  
and all of dem kon die.   
19 Den di pipol make one juju with gold for Mount Sinai  
kon dey bow for am.   
20 Dem shange dia God wey get glory  
bikos of one juju wey dem make.   
21 Dem forget God,  
dia Savior wey do many great tins for Egypt   
22 and plenty wonderful tins for Ham  
and for di Red Sea.   
23 So God kon sey E go distroy dem.  
But Moses, wey E choose kon stand between God and di pipol.  
E beg make God nor vex distroy dem.   
24 So some pipol nor enter di promise land,  
bikos dem nor bilive God promise wey sey,  
E go kare for dem.   
25 Instead, dem dey komplain for dia kamp  
and nor gri obey God.   
26 So, God swear sey E go kill dem  
for di wildaness   
27 kon skata dia shidren-shidren among di nashons  
and for far-far place.   
28 Den awa grand-grand papa join bigin woship Baal for Peor,  
dem even chop sakrifice wey dem offa give dead body!   
29 Dem make God vex with all dis tins,  
so wahala and diziz kon attack dem.   
30 But Finehas get strong mind kon stand for di pipol  
and di wahala and diziz kon stop.   
31 And from dat time, dem kon si am as raitious man.   
32 For Meribah, di pipol make God vex kon put Moses for trobol,   
33 bikos dem make Moses vex  
and e kon dey tok like fool.   
34 Israel pipol nor gri distroy all dia enemies wey dey di land,  
even doh God sey make dem distroy dem.   
35 Instead, dem bigin make friends with pipol wey nor know God  
kon dey follow dia wiked ways,   
36 den dem bigin woship dia juju  
and na dis make all of dem fall   
37 and dem even sakrifice dia sons  
and dotas give di demons.   
38 Dem kill innocent pipol kon sakrifice dia sons and dotas give Kanaan juju,  
so di land kon full with innocent pipol blood.   
39 Dem dirty diasef with di wiked tins wey dem don do  
and di way wey dem love juju kon make God dey vex   
40 and na dis make God leave en pipol  
wey bi en special propaty.   
41 E give dem to dia enemies and na pipol wey hate dem  
kon dey rule dem.   
42 Dia enemies opress dem  
kon make Israel pipol dey do wetin dem tok.   
43 Even doh God save dem many-many times,  
dem still choose to sin against am  
and dia sin kon finally distroy dem.   
44 But God still sorry for dem wen dem dey trobol  
kon listin to dia kry for help.   
45 E remember en kovenant with dem kon sorry for dem,  
bikos of en love wey nor dey fail.   
46 So dia enemies wey bi dia oga, God  
kon make dem trit Israel pipol well.   
47 Naw, my Oga God,  
make Yu kom save us!  
Make Yu gada us back from evriwhere wey wi skata go,  
so dat wi go tank yor holy name kon happy as wi dey praiz Yu.   
48 Make wi praiz di Oga wey bi Israel God wey dey alive forever and ever!  
Make all di pipol sey, “Amen!”