17
Aaron Stik
God tell Moses: “Make yu tok to Israel pipol kon kollect stik from each tribe; one from evry leader wey dey each tribe, yu go kollect twelf stik kon rite each man name put for en stik. Den yu must rite Aaron name put for Levi pipol stik; bikos each stik na for di leader for each tribe. Yu go put dem for di tent where dem for dey do meetin near di Kovenant Box where I for meet yu. And di man stik wey I go choose go prosper; so I go stop Israel pipol to dey komplain against yu.”
So Moses tok to Israel pipol and each leader gi-am one stik, one for each leader akordin to dia tribe. So all di stik na twelf; Aaron stik dey among. Moses put di stik before God for di tent where dem for dey meet.
Di next day, Moses enter di tent and Aaron stik for Levi house kon dey grow well-well with leaf, den e form one kind fruit wey dem dey koll almond! So Moses bring all di stik kom out from God present kon show Israel pipol and each pesin kon take en stik.
Remember
10 Den God tell Moses, “Make yu bring Aaron stik kom back before di Testimony Box kon keep am as sign for sturbon pipol, so dat dia komplain go stop and dem nor go die.” 11 So Moses do wetin God kommand am.
12 Israel pipol kon tell Moses, “Na die wi dey so! 13 If anybody wey go near God Tabanako, go die, dat mean sey all of us don die finish?”