16
Korah Sin
Naw some pipol from Reuben tribe kon sin, dis pipol na: Korah wey Izhar born, wey Kohat born, wey Levi born with Datan and Abiram wey Eliab bi dia papa and On wey Pelet born. Dem with some Israel pipol (two hundred and fifty popula prince from di kommunity) kon dey tok against Moses. Dem gada against Moses and Aaron kon sey, “Una own don too mush sef! Di kommunity dey holy; na God get am and E dey with all of us too. Why e kon bi sey yu Moses go dey karry body for God pipol?”
Wen Moses hear wetin dem tok, e bow for groun kon start to pray. Den e tell Korah and doz wey dey follow am sey, “Tumoro morning, God go show us who bi en own and who dey holy. Na only di pesin wey bi God own go fit enter en Holy Place. Tumoro morning yu and doz wey dey follow yu: make una bring una burn ofrin kontaina. Una go lite fire, put incense inside, den karry am go di altar. Den wi go si di pesin own wey God go take. Levi pipol, na una own worse pass!”
Moses tell Korah pipol again, “Levi pipol, make una listin to mi! Una tink sey e nor mean anytin to God wey choose una among Israel pipol to dey near am, so dat una go fit serve am for en Tabanako kon stand and dey prish to di pipol? 10 E don already give dis tins to both una and una fellow Levi pipol. And naw, una sey una won bi priest too! 11 So, na God una dey gada against! Who Aaron bi wey una dey komplain about?”
12 So Moses koll Datan and Abiram wey Eliab born, but dem ansa am, “Wi nor go kom. 13 Di one wey yu take us komot from Egypt wey get milk and honey neva rish yu? Yu still won kill us for di wildaness as yu dey trit us like yor savant? 14 Yu neva take us go any land where milk and honey full or sey yu give us where get vineyard as awa propaty. Yu tink sey yu go fit deceive us? Wi nor go kom.”
15 Moses vex well-well kon tell God, “Make Yu nor asept dia ofrin. I nor tif dia animal or do any bad tin against dem.”
16 Den Moses tell Korah, “Tumoro make yu and doz wey dey follow yu kom stand for God present and Aaron go kom too. 17 Make each of una take en own kontaina with incense kom meet God: Both Aaron and una two hundred and fifty kontaina with incense. Each pesin among una with en own kontaina wey incense full.” 18 So all of dem take dia kontaina with incense kon lite fire put, den dem stand for di tent where dem for dey do meetin door-mot, with Moses and Aaron. 19 Wen Korah gada di kommunity against Moses and Aaron for di tent door-mot, God glory kon appear to di whole kommunity.
Judgement
20 God tell Moses and Aaron: 21 “Make una komot from among dis kommunity, so dat I go distroy dem kwik-kwik.”
22 Den dem fall face groun kon sey, “My God, di God of all pipol spirit, Yu go vex for di whole kommunity wen e bi sey na only one pesin sin?”
23 So God tell Moses: 24 “Make yu tell di whole kommunity sey: ‘Make dem komot from Korah, Datan and Abiram tent.’ ”
25 So Moses get up go meet Datan and Abiram and di eldas for Israel, follow am. 26 E kon tell di kommunity sey, “Make una komot from doz wiked pipol tent and nor tosh anytin wey bi dia own, if not, God go distroy una bikos of dia sin.” 27 So dem komot from Korah, Datan and Abiram tent. Den Datan and Abiram kom out kon stand for di tent door-mot with dia wifes and shidren.
28 Moses kon sey, “Na so una go take know sey na God send mi kom do dis work, bikos I nor dey do am by mysef. 29 If dis men die normal deat without sey God ponish dem, den nor bi God send mi. 30 But if God do sometin wey neva happen before and di eart open swallow dem with all wetin dem get and dem die alive, den una go know sey dis men don rijet God.”
31 Wen e tok finish, di groun under Datan and Abiram open 32 kon swallow dem, with dia tent, all Korah men and with all dia propaty. 33 Dem and all wetin dem get enter groun alive, den di eart klose against dem. So dem die komot di kommunity. 34 Israel pipol wey dey der kon run komot wen dem hear di pipol dey kry. Dem kon dey shaut sey, “Make wi run o-o! Di eart fit swallow us too!”
35 Den God send fire kon distroy di two hundred and fifty men wey lite incense.
Di Fire Pan
36 God tell Moses: 37 “Make yu tell Eleazar wey Aaron di priest born sey, make e pick di kontaina wey dem dey put incense komot from di fire, bikos dem dey holy, den make dem pak di shako go far. 38 Di pipol wey die bikos of dia sin, make una use dia kontaina take make wetin dem go take kover di altar, bikos dem offa am to God, so dem dey klean. Dem go bi sign for Israel pipol.”
39 So Eleazar take di bronze kontaina kon use dem do kover for di altar. 40 Dis na warnin to Israel pipol sey, “Anybody wey nor kom from Aaron family, nor go fit burn incense to God for di altar. If not, e go die like Korah and en men.” All dis happen akordin to wetin God kommand Eleazar thru Moses.
41 But for di next day, di whole kommunity kon dey komplain against Moses and Aaron sey, “Una don kill God pipol.”
42 Afta dem gada against Moses and Aaron, dem turn face di tent where dem for dey do meetin kon si di kloud kover am and God glory kon appear. 43 Den Moses and Aaron stand for di tent where dem for dey do meetin. 44 God tell Moses, 45 “Make yu komot from dis kommunity, so dat I go distroy dem naw-naw!” Moses and Aaron kon bow face groun.
46 Den Moses tell Aaron, “Make yu take di kontaina with incense kon put fire inside am from di altar. Den kwik go di kommunity side go do sakrifice to make dem holy, bikos God go send one bad diziz kon meet dem, since E dey vex for dem.” 47 So Aaron do wetin Moses kommand and e run enter di pipol centre. Naw di diziz just dey start among di pipol. Aaron put di incense for der kon make dem holy. 48 E stand between doz wey don die and doz wey dey alive kon stop di diziz. 49 Naw, di pipol wey die with di diziz na 14,700 plus di pipol wey die bikos of Korah matter. 50 Afta di diziz stop, Aaron kon go meet Moses for di tent door-mot.