14
Israel Pipol Dey Fear
Den di pipol kon kry and dem kry well-well till di next day. Israel pipol kon bigin komplain against Moses and Aaron sey, “E for betta sey wi die for Egypt or for di wildaness! Wetin make God bring us kom dis land, so dat dem go kill us for war? Dem go katch awa wifes and shidren go as slaves! E for betta sey wi go Egypt back o-o?” So dem kon dey tell demsef sey, “Make wi choose new leader wey go take us go Egypt back!”
Den Moses and Aaron fall face groun for di pipol front. Joshua wey Nun born and Kaleb wey Jefunneh born wey dey among di men wey go shek di land kon tear dia klot, bikos dem dey vex den dem sey, “Di land wey wi go shek dey good well-well. If God dey happy with us, E go take us go der kon give us dat land wey full with milk and honey. Make una nor dey sturbon to God and make una nor fear di pipol wey dey di land, bikos dem bi like bread to us. God dey with us and E don defeat di gods wey dey protet dem; so make una nor fear.” 10 But di pipol kon dey plan to stone Joshua and Kaleb. Den God lite kon appear to Israel pipol for di Tabanako.
God One Ponish Dem
11 Den God tell Moses, “How long my pipol go rijet mi? Dem nor go ever bilive mi, even afta all di signs wey I don do for dia present? 12 I go strike dem with diziz kon distroy dem, den I go make anoda nashon thru yu and e go dey great and mighty pass dem!”
13 But Moses ansa, “Na Yu bring dis pipol komot from Egypt with yor pawa. Egypt pipol know wetin Yu don do for yor pipol wen Yu save dem. 14 Naw, if Yu distroy dem, wetin yu wont make Egypt pipol tell di pipol for dis land, wey don already bilive sey Yu dey among yor pipol? My God, dem know sey Yu don appear to yor pipol face-to-face. Yor kloud dey kover dem for day time and for nite, yor fire dey with dem. 15 If Yu kill all yor pipol, di nashons wey don hear about Yu go kon sey, 16 ‘Na bikos Yu nor fit take yor pipol go di land wey Yu promise dem, naim make Yu kill dem for di wildaness.’
17 “So my God, I dey pray, make Yu show yor pawa kon give us wetin Yu promise wen Yu sey, 18 ‘Mi wey bi God, I nor dey kwik vex and I dey show my love and goodness well-well. I dey forgive pipol sins and sturbones, but I go still ponish dia shidren-shidren go rish dia third and fourt generashon, bikos of di sin wey dia papa and mama kommit.’ 19 Abeg, make Yu forgive dis pipol akordin to yor love wey nor dey shange; wey strong well-well, just as Yu take forgive dem for Egypt kon rish naw.”
20 Den God ansa, “I don forgive dem as yu tok. 21 But I promise sey, as long as I dey, 22 non of dis pipol go dey alive to enter di land. Dem don si my glory and mirakle wey I do for Egypt and for di wildaness, but dem don too try my patient, bikos dem nor gri obey mi. 23 Doz wey rijet mi nor go ever enter di land wey I promise dia grand-grand papa. 24 But bikos my savant Kaleb nor bihave like di oda men and bikos e obey mi, I go take am go di land wey e go spy and en shidren-shidren go stay der. 25 (Naw Amalek and Kanaan pipol dey stay for di valley.) Tumoro, make una turn back kon travel go di wildaness for di road wey dey near di Red Sea.”
God Ponish Di Pipol
26 God tell Moses and Aaron: 27 “How long I go take bear di evil wey di pipol dey tok about mi? I don hear Israel pipol komplain about mi. 28 Make una tell dem sey, ‘As long as I dey, I go do anytin wey yu sey make I do. Na mi wey bi God tok am. 29 Una dead body go skata for dis wildaness, bikos una don komplain against mi. Nobody among una wey bi from twenty years go up, go enter di land. 30 I promise sey I go give Israel pipol di land, but una nor go enter der, apart from Kaleb and Joshua. 31 Una sey dem go katch una shidren, but I go take dem go di land wey una rijet and e go bi dia own. 32 Una go die for dis wildaness. 33 Una go waka anyhow for di wildaness for forty years kon sofa until di last pesin among una go die, bikos una nor good at-all. 34 Akordin to di days wey una take shek di land, na so too una go sofa for una sin for forty years; one day go bi for one year, den una go know how e bi to make mi vex!’ 35 Mi God don sey, ‘I go do wetin I tell dis wiked pipol wey gada togeda against mi. All of dem go die for dis wildaness. Mi wey bi God, don tok.’ ”
36 Di men wey Moses send go shek di land, wey kom back kon make Israel pipol dey komplain against God, bikos of di bad tin wey dem tok about di land; 37 doz men wey bring di evil ripot about di land, God kon kill dem with diziz. 38 And out of di twelf pipol wey Moses send go shek di land, na only Joshua and Kaleb, remain.
First Attack
39 Wen Moses tell Israel pipol wetin God tok, dem kon dey komplain more-more. 40 Early di next morning, dem start to travel go di hill kountries kon sey, “Naw wi don ready to go di place wey God don dey tell us. Wi know sey wi don sin.” 41 But Moses ansa dem, “Den why una kon dey disobey God? Una nor go fit win! 42 Make una nor go, bikos God nor dey with una and una enemies go win una, 43 bikos Amalek and Kanaan pipol dey wait una and dem go kill una well-well. Bikos una don turn from God, E nor go-go with una.”
44 But dem still go di kountry on-top di hill, even doh God Kovenant Box and Moses nor dey with dem. 45 Amalek and Kanaan pipol for der kon attack and porshu dem go rish Hormah.