13
Pipol Wey Go Spy
God tell Moses: “Make yu send men go shek Kanaan land wey I won give Israel pipol. Yu go send one man from each of di twelf tribe. Make each one bi leader for en tribe.” So Moses send dem komot from Paran Wildaness, just as God kommand. All di men wey e send, na leaders for Israel. Na dia names bi dis:
From Reuben tribe, e send Shammua wey Zakkur born;
from Simeon tribe, e send Shafat wey Hori born;
from Judah tribe, e send Kaleb wey Jefunneh born;
from Issakar tribe, e send Igal wey Josef born;
from Efraim tribe, e send Hoshea (Joshua) wey Nun born;
from Benjamin tribe, e send Palti wey Rafu born;
10 from Zebulun tribe, e send Gaddiel wey Sodi born;
11 from Josef tribe (wey bi Manasseh tribe), e send Gaddi wey Susi born;
12 from Dan tribe, e send Ammiel wey Gemalli born;
13 from Asher tribe, e send Setur wey Mikael born;
14 from Naftali tribe, e send Nahbi wey Vopshi born;
15 from Gad tribe, e send Geuel wey Maki born.
16 Dis na di men wey Moses send go shek di land. Hoshea wey Nun born, Moses kon shange en name to Joshua.
How Dem Take Spy
17 Wen Moses send dem go shek Kanaan land, e tell dem, “Make una go thru Negev and all di hill kountries 18 and si wetin di land bi like. Weda di pipol wey dey stay der strong or weak, small or plenty, 19 or weda di land dey good or bad; weda di towns wey dem dey stay bi like kamp or betta town; 20 weda di land dey rish or poor; get forest or not. Make una dey strong kon bring some fruit wey dey di land kom.” Naw, dis na di time for di year wen di first grape dey ripe.
Di Spy Work
21 So dem kon go shek di land from Zin and Rehob Wildaness, where dem dey pass enter Lebo-Hamat. 22 Wen dem pass thru Negev, dem kon rish Hebron for Ahiman, Sheshai and Talmai, where Anak shidren-shidren dey stay. (Naw, dem don build Hebron seven years before dem build Zoan for Egypt.) 23 Wen dem rish Eshkol Valley, dem kon kut one branches wey grape full and two men karry am with stik. Dem still take some pomegranate fruit and fig follow body. 24 Dem koll di place Eshkol Valley, bikos of di many grape wey Israel pipol kut from der. 25 Den, dem kon kom back afta forty days, wen dem don shek di land.
Di Spy Ripot
26 Dem kom back kom meet Moses, Aaron and Israel pipol for Paran Wildaness wey dey Kadesh kon tell dem evritin wey dem si and show dem di fruit wey dem bring from di land. 27 Dem tell Moses, “Wi go di land wey yu send us. True-true, milk and honey full der and dis na di fruit wey dey der. 28 But na strong and big pipol dey stay der and di town get betta wall and dem dey guide am well-well. Wi still si Anak shidren-shidren for der. 29 Na Amalek pipol dey stay for di sout part for di land; na Hit, Jebus and Amor pipol dey di kountries for hill; Kanaan pipol dey near Mediterranean Sea and along Jordan River.”
30 Den Kaleb tell di pipol sey make dem shut up kon sey, “Wi go attack naw kon take di land; wi dey strong and wi go fit konker di land.”
31 But di men wey go with Kaleb kon sey, “No, wi nor strong rish to fight dem; di pipol wey dey der get pawa pass us.” 32 So dem make Israel pipol bilive sey dem nor go fit konker di land wey dem go spy kon dey sey, “Di land nor go fit produce food for all di pipol wey dey stay der. All di pipol wey wi si der, big well-well 33 and wi even si some giant for der (wey bi Anak shidren-shidren) and wi bi like ant for dia front.”