2
Jesus Heal One Man Wey Paralaiz
Afta some days, wen Jesus go back to Kapanaum, news spread sey e dey house. Many pipol kon gada and di house full sotey space nor dey to enter or stand near di door. So Jesus kon bigin prish God word give dem. Some pipol kon karry one man wey paralaiz kom. As dem nor si road pass go meet Jesus, bikos pipol plenty der, dem kon remove di zink on-top di house for where Jesus sidan, den dem kon small-small drop di bed wey di man liedan put till e rish groun. Wen Jesus si as dia faith strong rish, e kon tell di man wey paralaiz, “My pikin, I forgive yu all yor sins.”
So some law tishas wey sidan der kon dey tink wetin Jesus tok for dia mind dey sey, “Why dis man dey tok like dis? E dey shalenge God! Who fit forgive sins escept God?”
At wons, Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, so e kon ask dem, “Why una dey tink like dis? Wish one eazy pass to tok? ‘I forgive yu yor sins,’ or ‘Get up, karry yor bed make yu waka?’ 10 But make dem for know sey Man Pikin get pawa for dis world to forgive sins, Jesus kon tell di man wey nor fit waka, 11 ‘I tell yu, get up, karry yor bed, make yu go yor house.’ ” 12 At wons, di man get up, karry en bed travel for dia front. Dem sopraiz well-well kon dey praiz God dey sey, “Wi neva si dis kind tin before!”
Jesus Chop With Sinnas
13 Jesus kon go di wotaside again and pipol kom meet am for der, so e kon start to tish dem. 14 As e dey waka for road, e si Levi, Afius pikin, sidan for where dem dey kollect tax. E tell am, “Make yu follow mi.” So Levi get up kon follow Jesus.
15 As Jesus dey chop for Levi house, many tax kollectors and sinnas dey chop with en and en disciples, bikos di pipol wey follow am, plenty. 16 Wen di law tishas and di Farisee pipol si sey e dey chop with sinnas and tax kollectors, dem kon ask en disciples, “Why una oga dey chop with tax kollectors and sinnas?”
17 Wen Jesus hear dis, e tell dem, “Pipol wey well nor nid doctor, but na doz wey nor well nid am. Nor bi good pipol I kom koll, but na sinnas I kom for.”
Jesus Tok About Fasting
18 Naw, John di Baptist disciples and di Farisee pipol dey fast. So dem kom meet Jesus sey, “Why John disciples and di Farisee pipol dey fast, but yor disciples nor dey fast?”
19 Jesus ansa dem, “Pipol wey kom marriage nor fit fast wen di man wey dey marry dey with dem, abi dem suppose to? So-far di man wey dey marry dey with dem, dem nor nid to fast. 20 But di time dey kom wen dem go take di man wey dey marry from dem, by dat time, dem go fast.
21 “Nobody dey tear new klot take pash old one. If e do like dat, di pash go tear di klot more and di whole go big pass as e bi before. 22 Nobody dey pour new wine inside wine bag wey don old; if not, di new wine go tear di bag, di wine go trowey and di bag go spoil. Instead, na inside new wine bag dem dey pour new wine put.”
Na Jesus Bi Sabat Day Oga God
23 Jesus kon dey waka pass di farm where dem plant korn put for Sabat Day and en disciples kon plok some korn as dem dey pass. 24 So di Farisee pipol tell am, “Si, why yor disciples dey break awa law for Sabat Day?”
25 Jesus ansa dem, “Una neva read wetin David do wen en and en men nor si food chop? 26 How en and en men enter God house wen Abiatar bi High Priest kon chop di holy bread wey only priests suppose chop?”
27 Jesus tell dem, “God make Sabat Day to help pipol, but nor bi sey make Sabat Day kontrol pipol life. 28 So, na God Pikin bi Sabat Day Oga God.”