Mark
Introdushon
Mark (en full name na John Mark), na Barnabas kousin (Kolossians 4:10). E work with Pita (one of Jesus disciple) and en mama house bi di place where bilivers dey meet for Jerusalem, naim rite di book. E rite am to di bilivers wey dey suffer persecushon from di govment for Rome (8:34-38; 13:9-13). Mark aim na to assure di bilivers sey Jesus Christ naim bi di true Savior, wey God send kon save not only Israel pipol, but Gentile pipol too. One Roman soja wey dey where dem dey kill Jesus konfess, “True-true dis man na God pikin!” Dis book get kweshons about Jesus like: Who pipol dey tok sey Jesus bi? So, afta Jesus don do plenty mirakles, en disciple kon really know sey Jesus, true-true, na God Son.
1
John Di Baptist Work
Na so di gospel about Jesus Christ, God Pikin take start.
As Profet Isaya tok for di book wey e rite,
“I dey send my messenja for front,
go prepare di way for yu.”
One pesin dey shaut inside wildaness sey,
“Make una prepare Oga God way for am,
make una make en road strait.”
For inside wildaness, John di Baptist kon bigin prish sey, make pipol leave di bad tins wey dem dey do, make e for baptize dem, so dat God go forgive dem dia sins. Pipol for Judea and all di aria wey near am and doz wey dey Jerusalem, dey go meet John and e kon baptize dem for Jordan River afta dem konfess dia sins. John wear klot wey dem take kamel hair make, tie leda belt for waist and e dey chop lokust and honey for inside bush. E kon sey, “Pesin wey big pass mi dey kom for my back and I nor big rish who go luz di rope wey dey en shoe. I dey use wota baptize una, but e go baptize una with di Holy Spirit.”
Jesus Baptizim And Temptashon
Dat time, Jesus kom from Nazaret wey dey for Galilee and John kon baptize am for Jordan River. 10 As Jesus dey kom out from di wota, heaven open and God Spirit kom down like dove kon land for en head. 11 Den one vois tok from heaven sey, “Yu bi My Pikin wey I love and yu dey make belle sweet Mi well-well.”
12 At wons, God Spirit kon take am go inside di wildaness. 13 E stay inside di wildaness where Satan tempt am for forty days. E dey der with wiked animals and God angels kon gi-am evritin wey e wont.
Jesus Koll En Disciples
14 Afta dem don put John for prison, Jesus kon enter Galilee dey prish di Good News sey, 15 “Di time wey God promise sey en kingdom go kom don rish. So make una leave di sins wey una dey do kon bilive di Good News.”
16 As Jesus dey waka for Galilee wotaside, e kon si Simon and en broda Andru wey dey trow net inside river, (bikos dem bi Fisha men.) 17 Jesus kon tell dem, “Make una follow mi and I go give una pawa to katch pipol.” 18 At wons, dem leave dia net kon follow Jesus.
19 As dem waka go front small, dem si James and John, wey bi Zebedee shidren inside boat dey ripair dia net. 20 At wons, Jesus koll dem, so dem leave dia papa, Zebedee, with di men wey dem hire for inside di boat, kon follow Jesus.
Jesus Pawa
21 Jesus with en disciples kon go Kapanaum. Wen Sabat Day rish, Jesus kon enter di sinagog bigin tish. 22 Di pipol sopraiz, bikos e sabi tish pass di law tishas. 23 For inside di sinagog, one man wey evil spirit dey inside en body kon shaut dey sey, 24 “Make yu leave us o-o, Jesus wey kom from Nazaret! Abi, yu don kom distroy us? I know who yu bi. Yu bi God Pikin wey dey holy.”
25 But Jesus kommand am, “Shut up and kom out from di man!” 26 Afta di evil spirit don shake di man well-well, e shaut kon kom out from di man body.
27 Evribody sopraiz dey ask each oda, “Wish one bi dis? Dis new tishing strong o-o! Even wiked spirit dey obey en kommand.” 28 So, di story about wetin Jesus dey do kon spread kwik-kwik for evriwhere for Galilee.
Healin For Simon House
29 As Jesus, James and John komot from di sinagog, dem kon enter Simon and Andru house. 30 Simon wife mama nor well, so dem kon tell Jesus about am. 31 Jesus go meet am, hold en hand and di woman kon stand up. Den di fever komot from en body and e kon dey serve dem.
32 Wen sun don dey go down for evening, dem kon bring all di pipol wey nor well and wey get demon kom meet Jesus. 33 Di whole town kon gada for di door-mot. 34 So, Jesus heal many pipol wey nor well with difren-difren diziz and e drive many demon komot from pipol body. But e nor let di demons tok, bikos dem know who e bi.
Jesus Work
35 For early morning wen evriwhere still dark, Jesus leave di house go one kwayet place go pray. 36 Simon and di pipol wey dey with am kon dey find am. 37 Wen dem si am, dem kon sey, “Evribody dey find yu.”
38 Jesus tell dem, “Make wi go anoda village, so dat I go prish for der too. Bikos na wetin I kom do, bi dat.” 39 So e kon go evriwhere for Galilee dey prish for dia sinagog and dey drive demon komot from pipol body.
Jesus Heal Leper
40 One man wey bi leper kom meet Jesus, knee down for en front dey beg am sey, “If yu wont, yu go fit make mi well.”
41 Jesus sorry for di man, so e tosh am kon sey, “I wont, so make yu well!” 42 At wons, di leprosy komot from di man body and e kon dey okay.
43 So Jesus warn di man well-well as e dey go sey, 44 “Make yu nor tell anybody about wetin happen so, but go show yorsef to di priest. And make evribody for know sey yu don klean, make yu take di ofrin wey Moses kommand, follow body.” 45 But as di man dey go, e kon bigin shaut for evriwhere dey spread di story, sotey Jesus nor fit enter any town again, so e kon dey stay where pipol nor dey. But pipol still dey kom meet am from evriwhere.