9
God Appear To Solomon
Afta Solomon don build di temple, di palis and evritin wey e won build, God appear to am again, just as E do for Gibeon. God tell am,
“I don hear yor prayers. Dis temple wey yu build for mi, I don make am holy for mysef and na der dem go for woship mi forever. I go wosh and kare for am always. If yu serve mi with yor whole mind, just as David yor papa do kon obey my laws and do evritin wey I kommand yu, I go do wetin I promise David yor papa, sey na en shidren-shidren go rule Israel forever.
But if yu and yor shidren-shidren stop to follow mi kon disobey di laws and kommand wey I give, den bigin follow oda gods, I go remove una from Israel pipol and di land wey I give dem. I go still abandon dis temple wey I don make holy sey make dem for dey woship mi. Pipol for evriwhere go laf Israel pipol and dem nor go respet dem again. Dis temple go skata and anybody wey waka pass, go sopraiz. Dem go sey, ‘Wetin make God do dis land and dis temple like dis?’ Pipol go ansa, ‘Na bikos dem abandon di Oga wey bi dia God wey bring dia grand-grand papa kom out from Egypt. Dem dey respet and woship oda gods, so God kon give dem dis kind big wahala.’ ”
Solomon And Hiram
10 Na twenty years Solomon take build di temple and en palis. 11 King Hiram for Tyre kon give Solomon all di cedar wood, pine wood and all di gold wey e wont for di work. Afta e don finish, Solomon kon give Hiram twenty towns for Galilee aria. 12 Wen Hiram si di towns wey Solomon gi-am, e nor like dem. 13 So e tell Solomon, “My broda, wetin make yu give mi dis kind towns?” So Hiram koll di towns Kabul (wey mean place wey nor good). 14 Before dis time, Hiram don give Solomon gold wey heavy rish 120 pounds.
Oda Tins Wey Solomon Do
15 Solomon force some pipol build di temple, di palis and e fill di land for di east side kon build di town wall. E still use dem take ribuild Hazor, Megiddo and Geza town. 16 Na Egypt king attack and kapture Geza before. E kill all Geza pipol kon burn di town. But wen en pikin won marry Solomon, e kon gi-am to di girl as marriage gift. 17 Solomon use en workers take ribuild am. Solomon still ribuild Lowa Bet-Horon; 18 Baalat, Tadmor for Judah desert; 19 di town wey dem keep en tins put; di town wey dem put en shariot and en horse dem and evry oda tin wey e won build for Jerusalem, Lebanon and oda place dem for en kingdom.
20 Na Kanaan shidren-shidren Solomon use take do all dis work. Dis na di pipol wey Israel pipol nor kill wen dem kom out from Egypt kon take-ova Kanaan. 21 Doz wey kom from Ammon, Het, Periz, Hiv and Jebus dey too and dia shidren still bi slaves for Israel till today. 22 Solomon nor use Israel pipol do slaves, but na sojas, ofisas, kommanders, pipol wey dey drive war horse and doz wey dey drive horse, dem bi to am. 23 Na 550 ofisas dey kare for doz wey dey work for difren-difren house wey Solomon dey build.
24 Solomon fill di land wey dey di east, afta en wife wey bi Egypt king pikin, don komot from David Town kon go stay di palis wey Solomon build for am.
25 Na three times a year Solomon dey give burnt and fellowship ofrin to God. E still dey burn incense give God. So e kon build di temple finish.
26 King Solomon still build sheep for Ezion-Geber wey dey near Elat for Akaba wotaside for Edom land. 27 Hiram send many of en men wey dey work for sea, go work with Solomon men. 28 Dem travel with ship from Ofir kon karry gold wey heavy rish 420 pounds go give King Solomon.