8
Solomon Karry Di Box Enter Di Temple
Solomon koll all di leaders for Israel tribe and villages kon tell dem, “Make una karry God Kovenant Box go di temple for Zion wey bi David Town.” Wen dem dey do Shelta Feast for Etanim mont (wey bi di sevent mont), all of dem kon gada, den di priest lift di Kovenant Box kon karry am go put for di temple. Levi pipol and di priest still karry di tent wey God for dey meet di pipol, with all di oda tins, go di temple. Solomon and Israel pipol gada for di Kovenant Box front kon sakrifice plenty sheep and melu.
Den di priest karry di Kovenant Box enter di temple kon put am for di Most Holy Place; under di creatures wey get feadas. Di creature feadas kover di pole wey dem take karry am. Na only di pesin wey sidan for di Most Holy Place front, fit si di pole end and nobody fit si dem from any oda place. Di poles still dey der till today. Na only di stone tablets wey God take make Kovenant with Israel pipol as dem dey kom from Egypt, dey inside di Kovenant Box and na Moses put am wen dem dey Mount Sinai.
10 As di priests dey komot from di temple, kloud kon kover di temple. 11 Di priest nor fit do anytin again, bikos God present don full di temple.
12 Den Solomon kon pray, “Oga God, Yu sey Yu go stay for darkness. 13 Naw! I don build big temple for Yu, place wey Yu fit stay forever.”
14 As di pipol stand for der, Solomon turn face dem kon bless dem with God name. 15 E sey, “Di Oga wey bi Israel pipol God, make all di praiz bi en own! E don do wetin E promise David my papa, wen E tell am sey, 16 ‘From di time wey I bring my pipol kom out from Egypt, I neva choose any town among Israel land where dem go build temple put to woship mi, but I choose yu, David, so dat yu go rule my pipol.’ ” 17 Solomon still sey, “David my papa plan sey e go build temple where dem go for woship di Oga wey bi Israel pipol God, 18 but God tell am, ‘Yu do well as yu won build temple for mi, 19 but yu nor go ever build am. Na yor own pikin go build my temple.’ 20 And naw, God don keep en promise. I don bi king for Israel afta my papa and I don build di temple where dem go for dey woship di Oga wey bi Israel pipol God. 21 I don still make place for di temple, where dem go keep di Kovenant Box and di stone wey dem rite di kovenant put, wey God make with awa grand-grand papa wen E bring dem kom out from Egypt, dey inside.”
Solomon Pray For Israel Pipol
22 Den, for di pipol present, Solomon go stand for di altar front, raiz en hand 23 kon pray,
“Di Oga wey bi Israel pipol God; e nor get any god wey bi like Yu for heaven or for eart! Yu do wetin Yu promise yor pipol kon show dem yor love, bikos dem obey Yu with dia whole heart. 24 Today, Yu don do wetin Yu promise David my papa. Yu don do evry word wey Yu tok. 25 And naw, my Oga! Yu wey bi Israel pipol God, I dey pray make Yu do all di oda tins wey Yu promise my papa wen Yu sey, na only en shidren-shidren go bi king for Israel, as long as dem obey Yu, just as dia papa, David obey Yu. 26 Naw, my Oga wey bi Israel God, make Yu do evritin wey Yu promise David my papa wey bi yor savant.
27 My Oga God nor dey really stay dis eart! If evriwhere for di sky and di heavens wey high pass nor fit kontain Yu, den how dis temple wey I build go bi to Yu? 28 Oga wey bi my God; I bi yor savant. Make Yu listin to my prayer kon do evritin wey I go ask Yu today. 29 Make Yu look dis temple both for day and for nite; di place where Yu choose sey make dem for dey woship Yu. 30 Make Yu hear mi anytime wey I face dis temple dey pray. Make Yu hear and forgive us from where Yu dey for heaven.
31 If dem tok sey pesin do anoda pesin bad and dem bring am kom yor altar for dis temple, den e swear sey e nor do am, 32 my Oga God, make Yu listin from heaven, den kon judge yor savants. Make Yu ponish di one wey do bad as e fit am kon free di one wey dey rite.
33 Wen Israel pipol enemies win dem, bikos dem sin against Yu and if dem turn to Yu for dis temple kon sey, ‘Papa forgive us’, 34 make Yu listin to dem from heaven. Make Yu forgive dem kon bring dem back to di land wey Yu promise dia grand-grand papa.
35 If Yu hold di rain, bikos yor pipol sin against Yu, wons dem turn from sin kom meet Yu kon pray to Yu for dis temple, 36 make Yu listin and ansa dem from heaven. Make Yu forgive di king and Israel pipol for dia sins kon tish dem di rite way. Den, my Oga God, make Yu send rain kom dis land wey Yu give yor pipol as dia own forever.
37 Wen honga dey di land; sickness or plants don spoil, bikos of strong wind, plenty lokust or wen enemies attack yor pipol; or sickness and diziz katch dem, 38 make Yu listin to dia prayers and if anybody wey dey face pain for Israel, stresh en hand pray for dis temple, 39 make Yu hear dia prayer and listin to dem from where Yu dey for heaven. Make Yu forgive and help dem. Na only Yu know wetin human being dey tink. Make Yu ponish or bless anybody as e fit am, 40 so dat yor pipol go always obey Yu as long as dem dey dis land wey Yu give dia grand-grand papa.
41 Wen pesin from anoda land hear di big-big tins wey Yu do for yor pipol, 42 dem go kon woship and pray to Yu for dis temple. 43 My Oga God, make Yu listin to dia prayer. For heaven wey Yu dey, make Yu hear and do wetin dem sey make Yu do, so dat evribody for di world go know and obey Yu, just as yor pipol Israel dey do. Den dem go know sey dis temple wey I build, na di place where dem go for dey woship Yu.
44 Wen Yu kommand yor pipol make dem fight war with dia enemies, if dem pray to Yu from anywhere and dem face dis town wey Yu don choose and dis temple wey I build for Yu, 45 make Yu listin to dia prayer. Make Yu hear dem from heaven kon give dem viktory.
46 Wen yor pipol sin against Yu (bikos e nor get who nor dey sin) and Yu vex kon let dia enemies defeat and karry dem like prisonas go anoda land. Even if di land far well-well, 47 make Yu still listin to yor pipol prayer. If dem turn kom meet Yu for dat land kon pray and konfess dia sin and di wiked tins wey dem don do, my Oga God, make Yu hear dia prayers. 48 If dem really turn from sin kon pray to Yu for dat land as dem face dis town wey Yu give awa grand-grand papa dem (dis town wey Yu don choose and dis temple wey I build for Yu), 49 den make Yu listin to dia prayers. Make Yu hear from heaven kon sorry for dem. 50 Make Yu forgive dem wen dem sin against Yu kon make dia enemies dey respet dem. 51 Dem bi yor pipol wey Yu karry komot Egypt; place wey bi like sey na fire dey burn dem.
52 Oga God, make Yu always dey favor Israel yor pipol and dia king, den hear dia prayer wen ever dem koll Yu for help. 53 From all di pipol, Yu choose Israel pipol to bi yor own, bikos na so Yu tell dem thru Moses yor savant, wen Yu bring dem kom out from Egypt.”
Di Last Prayer
54 Afta Solomon don pray to God finish, e stand for di altar front where e knee down and raiz en hand since. 55 Wen e stand up, e bless or di pipol as e shaut dey sey:
56 “Make wi praiz God wey don give en pipol peace, just as E sey E go do. E don do all di tins wey E promise Moses en savant. 57 Make di Oga wey bi awa God dey with us as E bin dey with awa grand-grand papa dem and make E nor leave or abandon us. 58 Make E make us dey obey am, so dat wi go always dey live as E wont make wi live kon keep di laws wey E give awa grand-grand papa. 59 Make awa Oga God remember all di prayer and komplain wey I don make with am since. Make E always dey show mesi to Israel pipol and dia king wen dem koll am evriday, 60 so dat all di nashons go know sey na only God bi God and e nor get anoda god. 61 Make una wey bi en pipol dey faithful to am and dey always obey en laws and kommand.”
Dem Dedikate Di Temple
62 Den King Solomon and all di pipol kon sakrifice give God. 63 Dem sakrifice 22,000 melu and 120,000 sheep as fellowship ofrin. So di king and all di pipol dedikate di temple.
64 Di king still dedikate di kourtyard centre with di aria for di temple front kon burn di whole sakrifice for der. E give di grain and all di fat animals as fellowship ofrins.
65 For di temple, Solomon and all Israel pipol kon celebrate Shelta Feast for fourteen days. Many pipol kom from Hamat Road wey far well-well for nort and from Egypt borda for sout. 66 For di Fifteent day, Solomon kon sey make all di pipol go dia house. All of dem praiz God kon happy go dia house, bikos of all di blessings wey E don give David, en savant and all Israel pipol.