20
War With Siria
King Ben-Hadad for Siria gada all en sojas, with thirty-two oda kings, with dia horse and shariot, den dem mash go attack Samaria. King Ben-Hadad send messenjas go meet and tell King Ahab, “Make yu surenda yor silva and gold; yor wimen and yor shidren wey strong well-well give mi.”
King Ahab ansa, “Make una tell my oga, King Ben-Hadad sey I gri. Make e take mi and evritin wey I get.”
Leta di messenjas kom back to King Ahab sey King Ben-Hadad still dey ask for anoda tin, “I bin sey make yu give mi all yor silva and gold, yor wimen and shidren. But I go send my ofisas make dem take yor palis, yor ofisas house and evry betta tin wey dey inside. Na dis kind time dem go take kom tumoro.”
King Ahab koll di leaders kon tell dem, “Una si sey dis man won kollect evritin wey wi get? E sey make I gi-am my wifes, shidren, silva and gold and I gri.”
Di leaders and di pipol ansa, “Make yu nor listin to am, nor gri!”
So King Ahab tell King Ben-Hadad messenjas sey, “Make una go tell di oga my king sey I gri for di first tin wey e tok, but I nor gri for di sekond one.” Den di messenjas go kon kom back with anoda message 10 from Ben-Hadad sey, “I go bring men kom distroy dis yor town and dem go use dia hand karry all di good tins komot. Make di gods kill mi, if I nor do am.”
11 Ahab ansa, “Make una tell King Ben-Hadad sey, ‘Betta soja nor dey make mout until e fight en war finish.’ ”
12 Dem tell King Ben-Hadad wetin King Ahab tok for where en and en oda rulers sidan dey drink for dia tent. So e kon give en men orda sey make dem ready to attack di town, den dem divide diasef into group.
13 But one profet go meet Ahab kon tell am, “God sey, ‘Make yu nor fear doz many sojas! I go make yu win dem today and yu go know sey, na mi bi God.’ ”
14 Ahab ask, “Who go lead for di attack?”
Di profet ansa, “God sey make e bi di yong sojas wey di district govnor dey kommand.”
Di king kon ask, “Den who go kommand di main sojas?”
Di profet ansa, “Na yu.”
15 So di king koll di 232 yong sojas wey dey under di district kommander. Den e koll all Israel sojas and dem bi 7,000 men. 16 Dem attack for aftanoon wen King Ben-Hadad and en thirty-two kings wey e karry follow body dey drink for dia tent. 17 Na di yong sojas kom out first.
Pipol wey Ben-Hadad send go, kom tell am sey some sojas dey kom out from Samaria.
18 Den e give orda sey, “Make una kill dem, weda dem dey kom fight or make peace.”
19 Na di yong sojas first attack, den Israel sojas kon follow dem for back 20 and each of dem kill di man wey e dey follow fight. Siria pipol kon dey run and Israel pipol bigin porshu dem, but King Ben-Hadad and some among en men enter horse kon run. 21 King Ahab enter di field, karry dia horse and dia shariot kon win Siria pipol.
22 Den di profet go meet King Ahab kon sey, “Make yu go back go train yor sojas kon make plan, bikos Siria king go attack una again for di next rainin sizin.”
Siria Attack Again
23 King Ben-Hadad ofisas kon tell am, “Na gods for mountin bi Israel pipol gods, naim make dem fit win us. But wi go win dem, if wi fight dem for ordinary groun. 24 Naw, make yu remove di thirty-two kings kon put doz wey sabi kommand sojas for field, yu go make dem di sojas oga. 25 Den koll sojas wey many like di ones wey run leave yu, with di same nomba of shariot and ordinary horse. Wi go fight Israel pipol for ordinary groun and wi go win dem dis time.” King Ben-Hadad gri kon follow dia advise.
26 For di next rainin sizin, e gada en men kon follow dem mash go Afek town go attack Israel pipol. 27 Israel pipol gada kon ready diasef; dem mash go kamp for two group kon face Siria pipol. Israel pipol bi like small-small goat, bikos Siria pipol plenty kon full evriwhere for di kountry.
28 One profet go meet King Ahab kon sey, “Dis na wetin God tok: ‘Bikos Siria pipol tok sey I bi god for mountin and nor bi for groun, I go make yu win dia many sojas and yu and yor pipol go know sey na mi bi God.’ ”
29 Israel and Siria pipol face diasef for dia kamps for seven days. For di sevent day, dem kon bigin fight and Israel pipol kill 100,000 Siria men. 30 Doz wey survive run enter Afek town where di town wall fall press and kill 27,000. King Ben-Hadad still run enter di town and e hide for di back room for one house.
31 En ofisas go meet am sey, “Wi hear sey Israel pipol kings dey show mesi. Make wi wear sak klot go meet am; may bi e nor go kill yu.”
32 So, dem wear sak klot go meet King Ahab kon tell am, “King Ben-Hadad yor savant dey beg yu make yu nor kill-am.”
King Ahab ansa, “E still dey alive? Okay! E bi like broda to mi!”
33 Ben-Hadad ofisas dey look how Ahab go tok and wen e sey, “Broda,” dem kon hold dat word sey, “Yu sey Ben-Hadad na yor broda!”
So King Ahab give orda sey, “Make una bring Ben-Hadad kom.” Wen King Ben-Hadad kom, King Ahab kon tell am sey make e enter di shariot with am.
34 Ben-Hadad tell am, “I go give yu di towns wey my papa kollect from yor papa and yu fit make one place wey yu go for dey sell for Damaskus, just as my papa do for Samaria.” King Ahab ansa, “If na bikos of dis, I go free yu.” E make agriment with am kon let am go.
One Profet Kondemn Ahab
35 As God kommand, one profet among all di profets kon sey make dem beat am.
But di oda profet nor gri, 36 so di first profet sey, “Bikos yu don disobey wetin God kommand, one lion go kill yu as yu just komot from here.” And as e komot, one lion kom out kon kill-am.
37 Den di same profet go meet anoda man sey, “Make yu beat mi!” Di man beat am well-well and e pain am. 38 Di profet bandage en face with klot kon shange ensef, den go stand for road korna dey wait make Israel king pass. 39 As di king dey pass, di profet koll am kon sey, “My king, I dey fight war and one soja bring enemy wey dem katch kon meet mi sey, ‘Make yu guide dis man. If e eskape; yu go die or yu go pay 3,000 silva koin.’ 40 But bikos I dey do oda tins, di man kon eskape.”
Di king ansa, “Yu don judge yorsef, so yu must pay di prize.”
41 Di profet tear di klot from en face and at wons, di king kon si sey na one of di profets. 42 Di profet kon tell di king, “Dis na wetin God sey make I tell yu, ‘Bikos yu let di man wey I sey make dem kill eskape, yu go use yor life pay for en own and dem go distroy yor sojas, bikos dem let en sojas eskape.’ ” 43 So di king go back to Samaria and di word kon dey worry am for mind.