19
Elijah For Mount Sinai
King Ahab tell Jezebel all wetin Elijah do and how e kill all di Baal profets with en swod. Jezebel kon send message go meet Elijah dey warn am sey, “Make di juju dem judge mi, if I nor kill yu by dis time tumoro, just as yu kill di Baal profets.”
Elijah kon dey fear, so e run go Beersheba for Judah. E leave en savant for der, as e dey travel go di wildaness. E go sidan under one big tree kon sey make God kill-am. E sey, “My Oga God, my eye don si wetin big pass mi, I beg, make Yu kill mi. I nor even betta pass my papa dem.” E kon sleep under di tree.
At wons, one angel tosh am kon sey, “Make yu stand up kon chop.” As e look, e si bread and wota for bottol near en head. E chop di bread and drink wota, den e sleep again.
God angel wake am di sekond time sey, “Get up make yu chop, bikos di waka wey yu won waka so, hard well-well.” Elijah get up kon chop and drink wota again, den di food gi-am pawa to take waka for forty days go di holy mountin for Sinai. For der, e enter inside one kave kon sleep dat nite.
At wons, God koll am, “Elijah, wetin yu dey do for here?”
10 E ansa, “My Oga God wey get pawa, na only Yu I dey serve, but Israel pipol don break di kovenant wey dem make with Yu. Dem skata yor altar kon kill all yor profets. Na only mi remain and dem won kill mi too!”
11 God tell am, “Make yu go stand for my front for di mountin. Si! God dey ready to waka pass.”
God send one strong breeze go shake di hills and di rocks, but God nor dey inside di breeze. Afta di breeze stop, di groun kon dey shake and swallow tins, but God nor dey inside. 12 Afta, fire kom out, but God nor still dey inside di fire too. Afta di fire, Elijah kon hear one small vois. 13 As e hear am, e kover en face with en klot kon waka go di kave door-mot for outside.
Den one vois tell am, “Elijah! Wetin yu dey do for here?”
14 E ansa, “My Oga God wey get pawa, na only Yu I dey serve. But Israel pipol don break di kovenant wey dem make with Yu. Dem skata yor altar kon kill all yor profets. Na only mi remain and dem won kill mi too.”
15 God tell am, “Elijah! Make yu go back to di desert wey dey near Damaskus, enter di town go anoint Hazael as Siria king. 16 Make yu still anoint Jehu wey bi Nimshi pikin, as Israel king. Den yu go anoint Elisha wey Shafat born, wey kom from Abel-Meholah, bikos na en go bi profet afta yu. 17 Anybody wey eskape and Hazael nor fit kill-am, Jehu go kill-am and anybody wey eskape from Jehu, Elisha go kill-am. 18 But I still get 7,000 pipol for Israel wey dey obey mi and neva serve Baal before.”
God Koll Elisha
19 Elijah komot from der kon si Elisha, wey Shafat born, dey work with twelf melu for en farm. E sidan on-top one, while eleven dey en front. Elijah remove en own klot kon use am take kover Elisha body. 20 So, Elisha leave en melu dem kon follow Elijah, den e sey, “Make I go tell my papa and mama, ‘Bye-bye,’ den I go follow yu.”
Den Elijah ansa, “Okay! Make yu go tell dem, but tink am well-well, before yu kom follow mi!”
21 Elisha go back kon kollect en own melu, kill and kook dem, den e give di meat to pipol make dem chop. So Elisha follow Elijah kon dey help am.