20
Abraham And Abimelek
Abraham travel from der go Negev aria kon stay between Kadesh and Shur. As Abraham bi strenja for Gerar, e kon tell pipol sey Sarah na en sista. So Abimelek wey bi king for Gerar kon koll and take Sarah.
But for dat nite, God kon appear to Abimelek for dream sey, “Na die yu won die so, bikos di woman wey yu take so, na somebody wife.”
For dis time, Abimelek neva do anytin with Sarah and di king kon ansa God sey, “I neva do any bad tin! So Yu go just distroy mi and my pipol like dat? But Abraham tell mi sey na en sista and even di woman still sey Abraham na en broda. All wetin I do na with betta mind and I neva do any bad tin.”
Den for di dream, God ansa am, “Yes, I know sey wetin yu do na with betta mind. Dat na di rizin wey make mi nor let yu sin against mi or tosh di woman. Naw, make yu give di woman back to en husband, bikos true-true Abraham na profet and e go pray for yu and yu nor go die. But if yu nor gri give di woman back to en husband, make yu know sey yu must die with evritin wey yu get, even all yor pipol.”
So di next day for early morning, Abimelek kon koll all en savants. Wen e tell dem evritin wey happen, fear katch all of dem. Di king kon sey make dem koll Abraham kom. Wen dem koll am kom, di king kon tell am, “Wetin bi dis wey yu do so? Na wish kind bad tin I do yu, wey yu won make mi and my kingdom kommit dis kind big sin? Yu don do sometin to mi wey yu nor suppose do!” 10 Den di king ask Abraham, “Wetin make yu do like dis sef?”
11 Abraham ansa, “Bikos I feel sey nobody dey wey dey fear God for dis place and dem fit kill mi if I sey na my wife. 12 Sarah na really my sista, my papa pikin, but nor bi my mama born am. I marry am 13 wen God take mi komot from my papa house and I kon tell Sarah sey, ‘Anywhere wi go, di only tin wey yu go do to show sey yu love mi, na to tell dem sey I bi yor broda.’ ”
14 Den Abimelek kon give sheep, kattle, man and woman savant to Abraham. And e still give Sarah back to Abraham en husband. 15 Den di king sey, “Si, na my land bi all dis place wey yu dey si so, make una choose anywhere una like to stay.” 16 Di king kon tell Sarah, “Si, I don give 1,000 silva to yor broda, so dat evribody wey dey with yu, go si and know sey yu nor do any bad tin.”
17 Abraham pray to God and God kon heal King Abimelek, en wife and en wimen savants, so dat dem go fit get belle born shidren, 18 bikos God klose dia belle make dem nor fit born, bikos King Abimelek bin kollect Sarah, wey bi Abraham wife.