19
God Distroy Sodom And Gomorrah
Di two angels kon rish Sodom for evening and dat time, Lot sidan for di town gate. Wen Lot si dem, e get up go meet dem kon bow face groun. E kon sey, “Una my oga! Abeg, make una kom enter una savant house. Make una wosh una legs and na here una go sleep dis nite. Den tumoro morning, una fit kontinue una journey.”
Di angels kon sey, “No! Wi go sleep for di town centre.”
Lot beg dem well-well, so dem kon enter en house. E kommand en savant make e bake bread without yist for dem and dem kon chop. Before di angels go bed dat nite, Sodom men kon surround di house. All di men for di town, both yong and old gada for der. Di men kon koll Lot dey sey, “Where di men wey kom meet yu dis evening? Bring dem kom out, so dat wi go sleep with dem!”
Lot go meet dem for outside kon klose di door. E kon ansa, “No my brodas! Make una nor do dis wiked tin! Si, I get two dotas wey neva sleep with man before. Make I give dem to una and una if do dem anytin wey una like. But make una nor do anytin to dis men, bikos na my house dem dey.”
Dem kon shaut gi-am sey, “Komot for awa front, yu wey bi strenja for dis place; na yu won tell us wetin wi go do! Wetin wi go do yu go worse pass wetin wi go do dem.” 10 But di angels inside Lot house open di door draw Lot enter inside kon klose am. 11 Di angel kon make di pipol eye blind; from di yong ones go rish di old ones. Den di men for outside kon dey find di door.
Lot Komot From Sodom
12 So di two angels kon tell Lot, “Yu still get anybody for dis town? Yor pikin husband dem dey di town? Abi yu get any broda or sista for here? Go tell dem make dem komot from dis town, 13 bikos wi kom distroy di town. Dia sin and di wiked tins wey dem dey do, don too many. So God send us kom distroy am.”
14 Den Lot go tell di men wey won marry en dotas sey, “Make una kwik-kwik komot from dis town, bikos God won distroy am!” But dem tink sey Lot dey lie for dem.
15 For morning, di angel kon tell Lot, “Make una dey go! Lot! Karry yor wife and shidren komot kwik-kwik, if not, wen God dey judge di town, dem go distroy una join!”
16 Wen Lot still dey slow, di angels kon drag en, en wife and en shidren komot di town, bikos God like Lot. Dem drop dem for outside di town. 17 Den one of di angels kon sey, “Make una run! Make nobody look back and make una nor stop for di valley until una rish di mountin, so dat nobody go die.”
18 But Lot ansa, “No! Abeg sir, nor let us run dat kind race. 19 Una don do betta tin for mi and my family as una save awa life. But di mountins too far, before wi go run rish der, di fire go kill us for road. 20 E get one small town for der and e nor too far. Abeg, make mi and my family run go der. If yu look, yu go know sey na small town and wi go dey save for der.”
21 Di angel kon sey, “Okay, I gri. I nor go distroy dat town. 22 So make una run go der, bikos I nor go fit do anytin until una rish der.” So na-im make dem dey koll di town Zoar, bikos Lot koll am, “small place”.
God Distroy Sodom And Gomorrah
23 Sun just dey kom out wen Lot and en family rish Zoar. 24 Den God send sulfur and fire like rain kom Sodom and Gomorrah 25 kon distroy dem, plus di valley with all di pipol for der and evritin wey dey grow for di land. 26 But Lot wife look back and e kon turn to salt.
27 For di next morning, Abraham rush go di place where e for stand for God present before. 28 E look face Sodom and Gomorrah side and all di valley, but na only smoke e si wey dey kom out from der. 29 But wen God distroy di town and valley where Lot dey stay. E keep Abraham for en mind kon allow Lot run komot di town.
Moab And Ammon Pipol
30 Bikos Lot dey fear to stay for Zoar, en and en dotas kon go di mountins go hide for one hole. 31 Di senior dota kon tell en sista, “Si! Awa papa don dey old and e nor get anybody for di whole world wey go marry and sleep with us, so dat wi go get shidren. 32 So, make wi give awa papa enough drink and wen e don high, wi go sleep with am, so dat wi go get belle kon born pikin thru am.” 33 So dat nite, dem kon make dia papa drink well-well and wen e don high and e nor know wetin e dey do again, di senior dota kon sleep with am.
34 Di next day, di senior dota kon tell en sista sey, “I sleep with papa yestiday nite; so make wi gi-am plenty drink today again, so dat yu go sleep with am.” 35 Dat nite, di girls kon make dia papa drink well-well and wen e don high and e nor know wetin e dey do again, di junior dota kon sleep with am. 36 Like dis, Lot kon give en dotas belle.
37 Di senior one born boy and e kon koll am Moab wey bi Moab pipol papa. 38 Di junior one born boy too and e kon koll am Ben-Ammi and na-im bi Ammon pipol papa.