15
God Make Kovenant With Abram
Afta all dis tins, God tok to Abram for vishon:
“Abram! Make yu nor fear!
Na mi dey guide yu
and yor reward go big well-well.”
But Abram sey, “My Oga God wey get pawa, wetin Yu go give mi, since I neva born pikin and na dis Elieza for Damaskus go inherit my propaty?” Abram still sey, “Since Yu neva give mi shidren, den one of my savants go inherit my propaty!”
But God sey: “Yor savant nor go inherit yor propaty, but na yor own pikin wey go kom from yor blood.” God take am go outside kon sey, “Look di sky and yu go si di stars, den try if yu fit kount dem!” Den God sey, “Na as di stars bi for up, na so yor shidren go plenty rish.” Abram bilive God and bikos of en strong faith, God kon koll am raitious man. God tell am, “Na mi bi di Oga God wey bring yu kom from Ur for Kaldea, so dat I go give yu all dis land as yor own.”
But Abram sey, “My Oga God wey get pawa, na wetin go bi di sign to show sey I go get all dis land?”
God ansa, “Make yu bring one melu, one goat and one ram; make all of dem bi three years, den take one dove and one yong pijin follow body.” 10 So Abram take all of dem go gi-am kon kut dem into two, den e put di two side face each oda, but e nor kut di birds. 11 Wen birds for sky won kon chop di tins wey Abram kill so, e kon porshu all of dem komot. 12 Wen nite rish, Abram kon sleep deep sleep, den fear kon dey katch am.
13 So God tell Abram sey, “Make yu know naw sey yor shidren go bi strenjas for anoda man land. Dem go ponish and trit dem like slave for four hundred years. 14 But I go judge di kountry wey go ponish dem. Afta evritin, dem go kom out with plenty propaty. 15 But for yu, wen yu don old well-well, yu go die with peace of mind kon go join yor grand-grand papa dem. 16 For di fourt generashon, yor shidren go kom back to dis place, bikos Amor pipol sin neva plenty rish.”
17 Wen evening rish and day don dark, one pot wey dey bring smoke with fire and dey shine like tosh kon pass between di animals wey Abram sakrifice. 18 Dat day, God kon make kovenant with Abram sey: “From Egypt borda go rish Eufrates River, I promise to give all dis land to yor shidren, 19 plus Kenite, Kenizz, Kadmon, 20 Hit, Periz, Refah, 21 Amor, Kanaan, Girgash and Jebus pipol land.”