14
Abram Save Lot
For dat time, Amrafel wey bi Shinar king, Ariok wey bi Ellasar king with Kedorlaoma wey bi Elam king and Tidal wey bi Goyim king kon gada go fight, Bera wey bi Sodom king, Birsha wey bi Gomorrah king, Shinab wey bi Admah king, Shemeba wey bi Zeboiim king and Bela king (di place wey dem also dey koll Zoar).
Dis five kings join togeda for Siddim Valley (wey bi Salt Sea). For twelf years, dem dey serve Kedorlaoma, but for di thirtint year dem kon fight against am.
For di fourteent year, Kedorlaoma and di kings wey join togeda kon go win Refah pipol for Ashterot-Karnaim, Zuz pipol for Ham, Emite pipol for Shaveh Kiriataim and Horite pipol for dia hill kountry wey stay Seir go rish El-Paran wey dey near di wildaness. Den dem go fight En-Mishpat (wey bi Kadesh) and dem win evry kountry wey dey for Amalek aria, even Amor pipol wey dey stay Hazazon Tamar.
Den Sodom, Gomorrah, Admah, Zeboiim and Bela (wey bi Zoar) kings kon ready for war. Dem meet each oda for Siddim Valley with Elam king, Ariok king, Amrafel king and Tidal wey bi king for some oda kountries. So na four kings dey go fight against five. 10 Naw, Siddim Valley get some portor-portor. Wen Sodom and Gomorrah king dey run, some for en men kon fall enter di pit, while di rest, run go di hills. 11 Di four kings wey win di war, kollect all di propaty and food wey Sodom and Gomorrah get, den dem kon go. 12 Dem still karry Abram broda pikin, Lot and en propaty follow body, bikos Lot dey stay for Sodom. 13 One pesin kon run go tell Abram wey bi Hibru. For dis time, Abram dey stay near Mamre wey bi Amor pipol oak. Dis Mamre na Eshkol and Aner broda. (All dis group don join Abram.)
14 Wen Abram hear sey dem dey karry en broda pikin go as slave, e kon koll en three hundred and eighteen men wey dem train well and dem born dis men for en house, den dem kon porshu di four kings go rish Dan. 15 So for nite, Abram divide en men against di four kings men kon win dem. E porshu dem go rish Hobah wey dey nort for Damaskus. 16 E kollect evritin wey dem tif. E still bring en broda pikin, Lot and en propaty with all di wimen and evribody kom back.
Melkizedek Bless Abram
17 Afta Abram don beat Kedorlaoma and di kings wey dey with am, Sodom king kon go meet Abram for Shaveh Valley (wey dem dey koll Kings Valley). 18 Melkizedek wey bi Salem king kon bring wine and bread kom out. (Dis Melkizedek na di Most High God priest.) 19 E bless Abram kon sey,
“Make di Most High God bless Abram,
di God wey kreate heaven and eart.
20 Make all praiz bi di Most High God own,
di one wey diliver yor enemies put for yor hand.”
Abram kon give Melkizedek one out of evry ten tin wey e bring kom back from di war.
21 Den Sodom king kon tell Abram sey, “Abeg give mi di pipol, make yu take evry oda tin.”
22 But Abram ansa, “I raiz my hand to di Oga God, di Most High God wey kreate heaven and eart and I promise 23 sey I nor go take anytin wey bi yor own. Nor bi even yor rope or sandal. So dat yu nor go sey, ‘Na mi make Abram get money.’ 24 I nor go take anytin escept di food wey my men chop and di tins wey dem use. But make my men, Aner, Eshkol and Mamre take dia share.”