4
Make Una Bi One
Mi wey bi prisona, bikos I dey serve di Oga God; I dey beg una make una dey live una life as God wont. Make una dey get pity for one anoda with kwayetnes, gentolness and patient, bikos of di love wey una get. Make una dey do evritin wey una fit do to keep di unity wey di Spirit dey give, as una dey live togeda for peace. Na one body and Spirit dey, bikos just as all of una get one hope from God wen E koll una, na so too una get one Oga God, one faith, one baptizim, one God and Papa wey dey above evribody; dey use evribody and dey inside evribody.
But God don give grace to all of us akordin to how Christ gift plenty rish. Na dis make dem sey, “Wen e raiz-up go heaven, E karry many prisonas wey E free follow body and E give plenty gift to pipol.” Na wetin dis word, “E raiz-up,” mean? E mean sey Christ first die and dem beri am for di eart. 10 En wey dem beri, naim still bi di pesin wey raiz-up pass di heavens, so dat e go komplete evritin. 11 Na Christ make some among us bi apostles, profets, evangelist, pastors and tishas. 12 Christ do like dis to prepare us for di ministry work, wey go make God church grow, 13 so dat wi go bi one for di tins wey wi bilive and wey go make us really know God Pikin. Den, wi go dey tink like Christ. 14 So make wi nor bi like shidren wey breeze dey karry up-and-down; shidren wey dey follow yeye tins wey human being dey tish and na dis tins dem dey take deceive pipol. 15 But, as wi dey do wetin dey good and korrect with love, wi go dey grow for evry side kon meet Christ wey bi di head. 16 Na from Christ di whole body dey grow well and join togeda thru di pawa wey dey support am. As each part dey do en work, na so di body go dey grow inside God love.
Holiness
17 So, I dey use Christ pawa take tell una dis tins sey, make una nor live una life like Gentile pipol wey dey tink only bad and tins wey nor get sense. 18 Dia mind dey for darkness and dem nor get part for di life wey God dey give, bikos dem sturbon and nor fit undastand. 19 Dem dey do wayo, dey give dia body to yeye tins; tins wey nor dey pure and dey wiked. 20 But wi nor tish una like dat about Christ. 21 If na thru, den una don hear and learn di trut about am, just as di trut dey inside Christ. 22 Koncerning di kind life wey una dey live before, wi sey make una trowey dat bad spirit wey dey make una do bad-bad tins 23 and make una dey tink betta tins for una mind. 24 Den, true raitiousness and holiness wey di trut dey bring, make una wear di new man wey God don kreate like ensef.
25 Since una don stop to lie, make una start to tok trut give una neighbour, bikos all of us na membas for Christ body. 26 If una dey vex, make una nor sin and make day nor dark still meet una dey vex. 27 Make una nor give di devil any shance. 28 Pesin wey dey tif, make e nor tif again. Instead, make e work hard and do good with en own hand, so dat e go fit give pipol wey nor get. 29 Make una nor allow any bad word kom out from una mout, but make una word dey give poor pipol hope, so dat e go bless pipol wey hear am. 30 Make una nor do wetin go make di Holy Spirit vex. Bikos na di Holy Spirit bi di mark wey God put for una body, so dat for judgement day, E go know doz wey E go save. 31 Una must stop to get bad belle; to dey vex; kworel and to dey tok bad-bad word. 32 Make una dey good to one anoda; dey sorry for pipol and dey forgive each oda, just as God forgive una thru Christ.