3
Paul Revelashon
Bikos of dis, mi Paul wey bi prisona for Christ, bikos of una wey bi Gentile pipol, dey pray give God. True-true, una don hear sey na God give mi dis work thru en grace and na for una own good. God open my eye to undastand en sekret, as I rite to una before, so dat wen una read am, una go fit undastand di sekret wey God show mi. Di pipol wey dey before nor know dis sekret as God don show en holy apostles and profets wey dey naw, thru di Holy Spirit. So, bikos of di gospel, Gentile pipol don follow Jew pipol get share for God blessing. Dem don bi membas for Christ body and dem get share for God promise. I bi dis gospel savant, bikos of God grace wey E give mi thru di work wey en pawa dey do. Na mi small pass for all God pipol, but God don give mi grace to prish di Good News give Gentile pipol and dis grace wey Christ give mi, nor dey finish. Di grace na to make evribody undastand God sekret plan. Na God kreate evritin and E hide di plan since e kreate di world. 10 E make dem undastand, so dat thru di church, all di rulers and pawas wey dey heaven go kon know God komplete wisdom, wey dey show ensef for difren ways. 11 Dis happen akordin to en plan wey go stand forever and E make am happen thru awa Oga God Jesus Christ 12 and na bikos Christ dey faithful, naim make us get di heart to fit rish where God dey. 13 Na dis make mi tell una sey, make una nor fear bikos of di tins wey I dey sofa, bikos na for una own good.
Paul Prayer
14 Bikos of dis, I dey knee down for awa Papa front, 15 where all di family for heaven and eart from get dia names. 16 I dey pray sey as en glory big rish, E go make una strong well-well with pawa thru en Spirit wey bi di really pesin inside una. 17 So dat Christ go dey inside una heart thru faith and wen una don strong well-well inside God love, 18 una go fit join all God pipol undastand how God love wide, long, high and deep rish. 19 Den una go really know di love wey Christ get, wey big pass evritin wey una go fit undastand and evritin inside God, go full una life.
20 So, make all di glory bi God own; di Pesin wey dey do pass di tins wey wi go fit ask or tink, thru en pawa wey dey work inside us. 21 Make all glory for Christ church bi en own from one generashon go rish anoda. Amen!