7
Wetin Stefen Tok
Di priest oga dem kon ask Stefen, “All dis tins wey dem tok about yu so, na true?” Stefen ansa, “My brodas and fada, make una listin to wetin I won tok so. Na wen Abraham, awa grand-grand papa dey for Mesopotamia, before e go stay for Haran, naim God wey get pawa, appear to am kon tell am sey, ‘Make yu leave yor kountry and yor pipol kon go di land wey I go show yu.’ So Abraham leave Kaldean kountry kon go stay for Haran. Afta en papa die, God kon tell am make e stay for dis land wey una dey naw. Dat time, God neva gi-am any part for di land and e neva born any pikin, but God promise am sey E go gi-am di land and en and en shidren go stay der forever. God tell am, ‘Di shidren wey yu go born go bi strenja for anoda kountry and di pipol for dat kountry go sofa dem kon use dem as slave for four hundred years.’ But God sey, ‘I go ponish di pipol wey go use dem as slave and afta all dis tins, dem go komot for der kon woship mi for dis place.’ So God make kovenant with Abraham thru sekonsishon. Abraham kon born Isaak and sekonsaiz am afta eight days. Isaak born Jakob and Jakob born di twelf brodas, wey bi awa grand-grand papa dem. Jakob shidren wey bi awa grand-grand papa dem, bikos dem dey jealous Josef dia broda, dem kon sell am as slave go Egypt, but God dey with am 10 kon save am from all en wahala and from Fero wey bi Egypt king, E gi-am favor with wisdom and Fero kon make am oga for di whole Egypt and ova evritin wey e get. 11 Honga kon dey for di whole Egypt and Kanaan and awa grand-grand papa dem nor si food chop. 12 So wen Jakob hear sey food dey for Egypt, e kon send awa grand-grand papa dem go shek if na true. 13 Wen dem kom di sekond time, Josef show ensef give en brodas and Fero kon know Josef family. 14 Josef send message go give en papa Jakob sey make en and all di pipol wey dey with am kom Egypt and dem bi seventy-five wey go. 15 So Jakob and awa grand-grand papa dem go Egypt and dem die for der. 16 Dia bone dey der till dem karry dem go beri for Shekem for di grave wey Abraham buy from Hamor shidren.
17 “But as time dey near wen God go fulfil di promise wey e make with Abraham; Israel pipol kon dey many inside Egypt, 18 till anoda Fero wey nor know Josef kon dey rule. 19 E deceive and sofa awa pipol sotey e force dem to leave dia shidren make dem die. 20 Na dat time dem born Moses and God kon like am well-well. Moses stay for en papa house for only three monts 21 and wen dem trowey am for river, Fero dota kon take and train am as en own pikin. 22 So dem tish Moses all di wise tins wey Egypt pipol dey do and e kon get wisdom for how e dey tok and wetin e dey do. 23 But wen forty years don rish, e kon tink am sey e good make e go visit en own Israel pipol. 24 Wen e si one man from Egypt dey opress one Israel pesin, Moses kon defend and kill di Egypt man. 25 E tink sey en own pipol go undastand sey God won use am take save dem, but dem nor undastand. 26 Di next day, Moses si two Israel men dey fight and e won try setol dem. So e tell dem, ‘My pipol, una bi brodas, why una kon dey fight unasef like dis?’ 27 But di man wey dey opress en broda kon sey, ‘Who give yu pawa to rule and judge us? 28 Hope yu nor won kill mi di way yu kill dat Egypt man yestiday?’ 29 Wen di man tok like dis, Moses run go Midian, anoda land where e stay as strenja kon born two boys for der.
30 “Afta forty years don pass, one angel appear to am for inside wildaness for Mount Sinai, where one bush for dey burn. 31 As Moses si dis tins, e sopraiz well-well and wen e waka near make e si am well, e hear God vois wey sey, 32 ‘Na mi bi di God wey yor grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob dey woship.’ Moses start to shake and fear nor let am look too mush. 33 But God tell am, ‘Make yu pul yor shoe komot from yor leg, bikos di place wey yu stand so, na holy Groun. 34 I don si as my pipol dey sofa for Egypt and I don hear as dem dey kry, so I don kon save dem. Make yu kom, bikos I won send yu go Egypt back.’
35 “Dis Moses wey dem rijet and ask sey, ‘Who make yu awa oga and judge’, naim God kon send make e bi oga and Savior thru di angel wey appear to am for bush. 36 Na dis Moses lead dem komot from Egypt. E still do plenty mirakles for Egypt, di Red Sea and inside di wildaness for forty years. 37 Na dis Moses tell Israel pipol sey, ‘Na from among una God promise sey, E go raiz-up one profet wey go lead una.’ 38 Na dis same man dey with di pipol for wildaness; with di angel wey tok to am for Mount Sinai; with awa grand-grand papa dem and e kon receive God word for una. 39 But una papa nor gri obey am. Instead, dem nor ansa am, but dem shange dia mind sey dem won go Egypt back. 40 Dem kon tell Aaron, ‘Make yu do juju for us wey go lead us bikos, wi nor know wetin don happen to Moses!’ 41 So dem make image wey bi like melu, sakrifice gi-am kon bigin serve di melu wey dem take dia own hand make.
42 “God leave dem make dem woship stars to make wetin Profet Amos tok, happen sey, ‘Israel pipol, una tink sey na mi una dey serve wen una dey sakrifice animal for inside wildaness for forty years?’ 43 ‘Na bikos of di house wey una build for “Molek and Refan”, wey bi una god and juju wey una dey woship, naim make mi send una go bi slave for Babilon.’ 44 God give di Tabanako to awa grand-grand papa dem, di house where dem go for woship am, just as E sey make Moses build am.
45 “Afta, awa grand-grand papa dem karry di Tabanako wey God give dem with Joshua kon drive all di oda tribes and take dia land till di time wey David bigin rule Israel. 46 God favor David well-well and e sey e go build house for God 47 but na Solomon en pikin kon build am. 48 Wi know sey God nor dey stay for house wey human being build, just as di profet tok,
49 “ ‘Heaven na my chair
and na di eart I dey put my leg,
so wish kind house una go fit build for mi
or wish kind place I go stay?
50 Nor bi mi make all dis tins by mysef?’
51 “Si how una sturbon! Just as una grand-grand papa dem bi, na so una still bi too, bikos una don make una heart strong to disobey God! 52 E get any profet wey una grand-grand papa dem nor kill? Dem even kill di messenja wey tok before sey, ‘Di Raitious Man go kom and una go gi-am to wiked pipol and dem go kill-am.’ 53 Na una receive God law wey E send thru en angels, but una nor obey am.”
Dem Kill Stefen
54 As di kansol membas hear all di tins wey Stefen tok, dem kon dey vex well-well. 55 But Stefen, wey God dey use well-well, look strait go heaven kon si God glory and Jesus Christ wey stand for God rite hand. 56 Naim e shaut, “Look! I si heaven wey open and I si Jesus Christ, God Pikin, stand for en rite hand.” 57 But di pipol klose dia ear bigin shaut and all of dem kon rush am. 58 Wen dem don drag am go outside for di temple, dem kon start to dey stone am, den dem kon pul all dia klot give one man wey dem dey koll Saul, make e whole. 59 As dem dey stone Stefen, e kon pray, “Oga God, Jesus Christ, make yu receive my spirit.” 60 So e fall for groun kon shaut, “My Papa, abeg, make yu nor kount dis sin against dem.” Wen e tok so finish, e kon die.