6
Di Seven Deakons
As time dey go, wen di disciples don plenty, di Jew pipol wey dey tok with Greek language kon dey kworel with di oda kountry-men wey dey tok Hibru. Dem kon dey komplain sey, “Wen dem dey share food, di Hibru men dey sofa wimen wey dia husband don die.” So di twelf apostles gada evribody kon sey, “E nor good make wi leave God word wey wi dey prish kon put hand for food matter. So make una look round kon choose among una, seven men wey una know sey dey bihave well; di Holy Spirit dey use well-well and wey get sense, so dat dem go do dis work for us. So dat wi go fit put awa mind for prayer, as wi dey prish God word.” Evribody like wetin di apostles tok, so dem kon choose one man wey en name na Stefen, bikos di Holy Spirit dey use am well-well. Di odas wey dem choose, na Filip, Prokorus, Nikanor, Timon, Parmenas and Nikolas wey kom from Antiok and e dey serve God like Jew pipol. Dem show dem to di apostles. Di apostles put hand for dia head kon pray for dem. Na so God word start to spread and di disciples wey dey Jerusalem kon plenty well-well. And many priests kon bilive Jesus Christ.
Dem Arrest Stefen
God bless Stefen well-well kon gi-am pawa to take do many wonders and mirakles among di pipol. But some men kon dey argue with am. Dis men dey woship God for one place wey dem dey koll “Di Freedmen Sinagog.” Some among dem kom from Alexandria, Sirene, Silisia and Asia. 10 But dis pipol nor fit stand di wisdom and pawa wey Stefen take dey tok. 11 So, dem kon bribe some men make dem lie sey, “Wi hear wen dis man tok tins wey dey against Moses and God law.” 12 Dem lie for Stefen head, so di pipol, di eldas and di oga dem for di law kon hate am. So dem arrest Stefen kon karry am go di kansol. 13 Dem bring pipol kon lie sey, “E don tey wey dis man dey tok bad-bad tins about Moses Law and dis Temple. 14 Wi hear wen e dey tok sey Jesus Christ wey kom from Nazaret go skata dis place and e go shange all di tradishon wey Moses give us.” 15 Evribody wey dey di kansol dey look Stefen kon si sey en face dey shine like angel own.