4
Dem Arrest Pita And John
As Pita and John still dey tok, di priests, di temple guide oga and di Sadusi pipol waka kon meet dem. Dem dey vex, bikos Pita and John dey tish di pipol sey, na only thru Jesus Christ, pipol go fit wake-up from deat. So dem arrest dem put for prison till di next day, bikos nite don rish. But pipol wey hear wetin dem tok kon bilive Jesus Christ and di pipol wey bilive, rish 5,000.
Di next day, all di rulers, eldas and lawyers kon gada go Jerusalem. Annas, wey bi di High Priest dey der with Kaiafas, John, Alexanda and some membas for di High Priest family. Dem drag Pita and John enter dia centre kon bigin ask dem, “Who give una pawa to do dis tins? Na wish pesin name una dey use so?” Pita wey di Holy Spirit dey use well-well kon ansa, “Awa rulers and eldas, na bikos of di good wey wi do for dis pesin wey nor well, naim make una dey kweshon us today sey, ‘How dis man take well?’ 10 My pipol and di oga dem for Israel, make una know sey, Jesus Christ wey kom from Nazaret, di pesin wey una kill and God raiz am from deat, naim name make dis man wey una dey si so, well. 11 Dis Jesus Christ, di good stone wey una trowey, God don make am di main pila wey dey whole di house. 12 And na en pawa God dey use save pipol, bikos for di whole world, e nor get any oda name wey get pawa to save pipol, like Jesus Christ own.”
13 Di oga dem sopraiz wen dem si how Pita and John take tok even doh dem nor go skool. So dem kon know sey dis na di pipol wey don follow Jesus Christ waka. 14 As dem si sey di man wey God heal stand der with Pita and John, dem nor fit deny wetin happen. 15 So dem sey make Pita and John komot for where dem dey, den dem bigin ask each oda, 16 “Wetin wi go do about dis pipol? Bikos evribody wey dey for Jerusalem don know sey na big mirakle naim God use dem do so and wi nor go fit deny am. 17 But make di matter nor for kontinue dey spread among di pipol, make wi warn dem make dem nor tok about dis name again.” 18 So dem koll dem go inside kon warn dem make dem nor tok or tish about Jesus Christ name again. 19 But Pita and John ansa, “Make una judge wetin good pass for dis matter; make wi obey una or make wi obey God, 20 bikos wi nor go fit sey make wi nor tok about wetin wi don si and hear.” 21 Afta dem warn Pita and John well-well, di Jew pipol kon leave dem make dem dey go, as dem nor fit ponish dem for di pipol front, bikos dem gada dey praiz God for wetin happen so. 22 Di man wey receive dis big mirakle, don pass forty years.
Di Disciples Pray For Pawa
23 As dem free dem, Pita and John go meet dia pipol kon tell dem evritin wey di High Priest and di eldas tok. 24 Wen dem hear wetin happen, dem kon pray to God sey, “God wey dey for heaven, yu wey make heaven, eart, di sea and evritin wey dey inside dem. 25 Yor Spirit tok thru yor savant David, awa grand-grand papa sey,
“ ‘Wetin dey make pipol wey dey woship juju dey make nois?
Wetin make dem dey plan bad-bad tins?
26 All di kings wey dey di world stand and di rulers gada togeda
against Jehovah and di pesin wey E choose.’
27 “True-true, Herod, Pontius Pilate, Israel pipol and doz wey nor bi Jew kon gada for di town against Jesus Christ, yor holy savant wey yu choose 28 and dem dey do wetin yu don already plan sey go happen. 29 Papa God, make yu si how dem dey treaten us. Wi wey bi yor savants, make yu give us pawa to take prish yor word and 30 anytime wen wi koll Yor holy pikin Jesus Christ name, make yu heal pipol and do many wonderful mirakles.” 31 Wen dem pray finish, di place wey dem gada put kon dey shake. Di Holy Spirit enter all of dem and dem kon dey prish God Word with pawa.
How Di Early Bilivers Stay Togeda
32 All di pipol wey bilive Jesus Christ kon dey do tins togeda with one mind and nobody sey e go use wetin e get for ensef alone, so dem kon dey share dia propaty togeda. 33 With God pawa, di apostles kon dey bear witness sey Jesus Christ wake-up from deat and God favor kon dey show for dia life well-well. 34 Nobody among dem sofa, bikos di rish pipol among dem wey get land and house, dey sell dia propaty and bring di money wey dem sell 35 kon give di apostles make dem keep am, so dat dem go gi-am to anybody to take buy wetin e wont. 36 So Josef wey kom from Levi tribe and wey di apostles dey koll Banabas (wey mean pesin wey dey enkourage pipol) and en home-town na Cyprus, 37 sell one land wey e get kon give di money to di apostle make evribody use.