3
Pita And John Heal Pesin Wey Cripple
One day, Pita and John dey go di temple go pray for three oklok for aftanoon. Some pipol dey always karry one man, wey nor fit waka since en mama born am, kom di temple door-mot wey dem dey koll, “Beautiful Gate”, so dat e go dey beg for money from pipol, wey dey enter inside di temple. As di man si Pita and John wen dem won enter di temple, e kon dey beg dem for money, but dem look am strait for eye kon sey, “Make yu look us!” So di man wey nor fit waka kon look dem well-well, bikos e tink sey dem won gi-am money. Pita kon tell am, “I nor get silva or gold to give yu: but na wetin I get, I go give yu. With Jesus Christ name wey kom from Nazaret, stand up make yu bigin waka!” Pita hold di man for en rite hand kon drag am up and at wons, di man legs kon strong. Di man jump up bigin waka, e follow dem enter di temple dey waka, dey jump up-and-down, dey praiz God. Pipol si am dey waka dey praiz God 10 and dem remember en face kon sey, dis na di man wey dey sidan for di temple door-mot dey beg money, before. Di pipol sopraiz well-well, bikos of wetin happen.
Pita Tok To Di Pipol
11 Di man still dey jump follow Pita and John with happiness and di pipol still dey sopraiz. Den di pipol run go meet Pita and John for di place wey dem dey koll “Solomon Varanda.” 12 Wen Pita si sey all di pipol gada, e kon start to dey prish, “Israel pipol, wetin make dis mirakle dey sopraiz una like dis? Why una dey look us like sey na with awa own pawa or holiness wi take make dis man waka? 13 Na Abraham, Isaak, Jakob and awa grand-grand papa God, naim karry en savant Jesus Christ go up, di one wey una rijet kon gi-am to Pilate make e judge am, even wen e won free am. 14 Una sey una nor wont Jesus Christ, di holy and Raitious Pesin, instead una sey make dem release anoda pesin wey dey kill pipol give una. 15 Una kill di pesin wey dey give pipol life, but God raiz am from deat and wi bear witness sey dis na true. 16 Dat Jesus Christ name wey wi bilive, naim make dis man wey una dey si and know well-well, strong. Yes! Naim name don heal dis man as una dey si so. 17 So my brodas, I know sey una and una oga dem nor know wetin una do. 18 God don tok before-before thru all en profet sey, di Mezaya go sofa and E don make am happen, thru wetin una do. 19 So make una turn from sin kom meet God, make E for forgive una, 20 so dat una go fit get freedom wey God dey give and E go send Jesus Christ, di Mezaya wey E don prepare down, kom meet una. 21 Dis Jesus Christ go stay for heaven till di time wey God go make evritin betta again as E don tok thru en holy profets. 22 Even Moses sef tok before sey, Jehovah wey bi una God go send one profet to una, just as E send mi and e go bi una family memba. Una must obey evritin wey e sey make una do. 23 Anybody wey nor obey dat profet, dem go distroy am and dem go remove am from God family. 24 God don tok about all dis tins wey dey happen so, from Profet Samuel time go rish di profets wey kom afta am. 25 All of una get share for inside di promise wey God make with una grand-grand papa dem thru di profets. Na so E tell Abraham sey, ‘Na thru di pikin wey yu go born, naim I go take bless all di family wey dey di world.’ 26 So God don raiz en savant and E don send am give una, make e for bless and help una turn from sin kom meet am.”