26
Paul Defend Ensef
So Agrippa tell Paul, “Make yu tok for yorsef naw.” Den Paul raiz en hand kon start to tok.
“King Agrippa, about all dis tins wey di Jew pipol dey akuiz mi sey I do, I tank God sey I won defend mysef give yu today, bikos yu know all awa tradishon and di matter wey di Jew pipol dey akuiz mi about. So, Abeg, make yu listin to wetin I won tok. Naw, all di Jew pipol know sey na from small pikin I dey live my life with my own pipol for Jerusalem. Since dem know mi, if dem go gri kon tok, dem go gri sey na how wi dey serve God, naim I take live as Farisee. Naw, I stand make dem judge mi, bikos I put hope for di promise wey God make give awa grand-grand papa dem sey, awa twelf tribes go gain as dem dey use all dia mind dey serve God, both day and nite. My king, na bikos of dis hope wey I get, naim make di Jew pipol dey akuiz mi so! Why una tink sey God nor fit raiz pipol wey don die? Even mi mysef, I bilive before sey make wi fight Jesus Christ wey kom from Nazaret. 10 And na wetin I do for Jerusalem bi dat. Nor bi only sey I put many of di bilivers for prison with di pawa wey di priest oga dem give mi, but I even dey support wen dem sey make dem kill dem. 11 I ponish dem many times for all di sinagog and I try to force dem make dem curse God. Bikos dat time, I dey vex for dem well-well, I even travel go oda towns go sofa dem, bikos of wetin dem bilive.
12 “But one day, as I dey do all dis tins, I kon dey go Damaskus with full pawa wey di priest oga dem give mi. 13 My king, around aftanoon for road, I kon si one kind lite from heaven wey shine pass di sun. Di lite shine round mi and di pipol wey dey follow mi travel. 14 Wen wi don fall for groun, I hear one vois wey use Aramaik language tell mi, ‘Saul, Saul, why yu dey ponish mi? Yu dey fight yorsef, bikos na stone yu dey kick so.’ 15 So I ask am, ‘Oga God! Who yu bi?’ God ansa, ‘I bi Jesus Christ wey yu dey ponish. 16 But make yu get up, bikos I don show mysef to yu and don choose yu as my savant and witness to di tins wey yu don si and di ones wey I go show yu. 17 I go save yu from yor own pipol and from Gentile pipol wey I dey send yu go meet, so dat 18 yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’
19 “So King Agrippa, I nor do strong head wen I receive dis vishon wey kom from heaven, 20 but I first go Damaskus, go tell di pipol wey dey der and den, I kon go meet di pipol wey dey for Jerusalem and Judea. Afta, I go meet Gentile pipol sey, make dem turn from sin kom meet God and make dem do tins wey go show sey, dem don really turn from sin kom meet God. 21 Bikos of dis, di Jew pipol seize mi for di temple front, won kon kill mi. 22 But God don dey help mi till today, so I stand dey tell evribody, weda dem bi small pikin or big pesin. So, wetin di profets and Moses tok sey go happen, naim I dey tell una so, 23 sey Christ sofa and e go bi di first to raiz from deat, so dat e go show di lite to awa pipol and even Gentile pipol.”
24 As Paul dey defend ensef, Festus kon shaut, “Yu dis Paul, yu don dey kraze o! All di plenty book wey yu know don dey won make yu mad!” 25 But Paul ansa am, “I nor dey mad oga Festus, but na betta word wey dey good naim I dey tok so. 26 Even di king wey I dey tok to so, I bilive sey e know about all dis tins, bikos dem nor happen for sekret. 27 King Agrippa! Yu bilive di tin wey di profets tok?” 28 Agrippa ask Paul, “So yu tink sey just naw-naw, yu fit turn mi to Christian?” 29 Paul ansa, “I pray to God sey, weda na naw or leta, nor bi only yu, but evribody wey dey here, go bi like mi, but make una nor sofa, as I dey sofa so.”
30 So di king, di govnor and Bernice kon get up 31 and as dem dey go, dem kon tell each oda, “Dis man nor do anytin wey go fit make dem kill-am or put am for prison.” 32 Agrippa kon tell Festus, “Wi for fit release dis man, if to sey e nor sey make Caesar judge en kase.”