25
Paul Go Meet Caesar
Wen three days don pass, Festus komot from Caesaria go Jerusalem. So di priest oga dem and all di big men among di Jew pipol kon tell am wetin dem sey Paul do. Dem beg am make e give orda sey make dem bring Paul kom Jerusalem back, bikos dem plan to attack and kill-am for road. Den Festus ansa, Paul dey for Caesaria and mi mysef go soon go der. So e sey, “Make yor leaders follow mi go der and if dis man do anytin wey bad, make dem akuiz am.”
Festus nor stay rish eight or ten days wen e go Caesaria and di next day, e sidan for di judgement seat kon give orda sey make dem bring Paul kom. Wen Paul rish der, di Jew pipol wey kom from Jerusalem kon stand round am, dey akuiz am sey e kommit sin wey dem nor fit show. Paul defend ensef sey, “I nor kommit any offence against di Jew law or di temple or against Caesar.” Bikos Festus one make di Jew pipol happy, e kon ask Paul, “Yu ready to go Jerusalem make I judge yor kase for der?” 10 Paul ansa, “I stand for Caesar judgement seat, na here dem go for judge my kase. I nor kommit any offence to Jew pipol and even yu yorsef know. 11 I nor do bad and I nor kommit any offence wey dem fit take kill mi, I nor dey try to run sey make dem nor kill mi, but if evritin wey dem tok against mi nor bi true, nobody go fit karry mi, give dem. I sey make dem karry my kase go give Caesar!” 12 Festus kon sey, “Yu don tok sey make Caesar judge yor kase, so, na Caesar yu go-go meet!”
Paul Meet King Agrippa
13 Afta some days, King Agrippa and Bernice go Caesaria, go salot Festus. 14 As dem dey der for many days, Festus kon tell dem about Paul kase, so dat e go hear wetin dem go tok about di matter, so e koll Agrippa kon sey, “One man dey for here wey Felix leave for prison. 15 Wen I dey Jerusalem, di priest oga dem and di eldas kon tell mi about am sey make I kill-am. 16 But I ansa dem, ‘Rome law nor gri make dem kondemn anybody wen e neva face and defend ensef before pipol wey dey akuiz am.’ 17 So afta dem follow mi kom here, I kon pospone di kase, but di next day I sidan for judgement seat kon orda make dem bring di man kom. 18 Wen pipol wey dey akuiz am stand up, dem nor tok any bad tin against am as I bin suspet. 19 Instead, dem dey argue matter with am, about how dem dey serve God and one man wey dem dey koll Jesus Christ wey don die, wey Paul sey e still dey alive. 20 Bikos I nor know how I go take judge di matter, I kon ask am weda e go like go Jerusalem make dem judge am der. 21 But Paul sey make dem take am go Rome, so dat Caesar go judge en kase, so I kon orda sey make dem keep am for prison, until I go fit send am go meet Caesar.” 22 Agrippa kon tell Festus, “Mi too go like hear from di man.” So Festus tell am, “Yu go hear from di man tumoro.”
Paul Stand For King Agrippa Front
23 So di next day, Agrippa and Bernice kon dey make yanga enter di hall, with all di big men wey dey di town. Afta Festus don give orda, dem kon bring Paul. 24 Den Festus sey, “King Agrippa and all of una wey dey here with us, make una si dis man wey di whole Jew pipol dey beg mi both for here and for Jerusalem sey, make I kill. 25 But I kon si sey e nor do anytin wey go make dem kill-am and wen e sey e won make di emperor judge en kase, I kon gri sey I go send am go meet Caesar. 26 But I nor know wetin I go rite go give di emperor about am. So naim make mi bring am kom all of una and king Agrippa front, so dat afta una don kweshon am finish, I go get sometin wey I go fit rite. 27 Bikos for my mind, e nor dey rite to send prisona go kourt, wen yu nor rite wetin e do.”