13
Banabas And Saul Go Prish
Dis na di profets and tishas wey dey di church for Antiok: Banabas, Simeon wey dem dey koll Naija, Lucius wey kom from Sirene, Manaen (wey bi Herod di Tetrak friend from small pikin) and Saul. As dem dey fast and woship God, di Holy Spirit kon tell dem, “Make una separate Banabas and Saul for di work wey I wont make dem do.” Afta dem don fast and pray finish, dem pray for Banabas and Saul kon send dem go.
Paul And Banabas Prish For Cyprus
So Banabas and Saul wey di Holy Spirit send kon go Seleucia and from der, dem enter ship go Cyprus. Wen dem rish Salamis, dem kon dey prish God word for di Jew sinagog, (John dey der dey help dem.) Wen dem don cross di whole Island go rish Pafos, dem kon si one magician wey bi Jew and na wayo profet. En name na Bar-Jesus, e dey with Sergius Paulus, one Roman offisa wey know book well-well. Di offisa invite Banabas and Saul kom en house, bikos e won hear God word. But “Elymas” wey bi magician, (bikos na wetin en name mean bi dat) kon dey oppoz dem, so dat di Roman offisa nor go bilive wetin dem dey prish. But Saul (wey dem dey koll Paul) wey get di Holy Spirit, look Elymas for face 10 kon tell am, “Yu devil pikin wey nor like good tin, na so-so wayo and bad tins yu sabi do, yu nor go stop to dey oppoz God? 11 Naw, God don raiz en hand against yu. Yor eye go blind and yu nor go fit si for sometaim!” At wons, e eye just blind and darkness kover en face and e kon dey take hand find pipol make dem show am road. 12 So wen di Roman offisa si wetin happen, e kon bilive, bikos e sopraiz well-well for wetin dem tish about Jesus Christ.
Paul And Banabas Go Antiok For Pisidia
13 Paul and di pipol wey follow am kon travel from Pafos go rish Perga wey dey for Pamfilia, but John Mark leave dem kon go back to Jerusalem. 14 Wen dem komot for Perga, dem rish Antiok for Pisidia for Sabat Day kon enter di sinagog go sidan. 15 Afta dem don read from di law and di profets book, di oga for di sinagog kon send message go meet dem sey, “Awa brodas, if una get any message to take enkourage di pipol, make una kon tok naw.” 16 So, Paul stand up raiz en hand kon sey:
“Israel and Gentile pipol wey dey fear God, make una hear wetin I won tok: 17 Na from Israel pipol God choose awa grand-grand papa dem and E kon make dem great for di time wey dem dey Egypt as strenja and E karry dem komot from Egypt with en own hand. 18 For forty years, E stay with dem for inside wildaness. 19 Afta E don distroy seven tribes for Kanaan, E kon dash en pipol di land. 20 All dis tins happen for four hundred and fifty years. Afta dis, E kon give dem profet wey go judge dem, until Profet Samuel time rish. 21 Di pipol kon ask for king and God give dem Saul, wey bi Kish pikin, wey kom from Benjamin tribe and e rule dem for forty years. 22 Afta God remove am, E kon make David dia king. Na dis man God tok about sey, ‘I don si David, Jesse pikin, di man wey I like well-well and e go do evritin wey I wont.’ 23 Na from dis man family God give Israel, Jesus Christ, di Savior wey E promise dem before. 24 Before Jesus kom, John di Baptist don prish to all Israel pipol sey make dem turn from sin kom meet God and make e baptize dem. 25 But as John dey finish en work, e kon tok many times sey, ‘Wetin una tink sey I bi? Nor bi mi bi di Mezaya. Make una si, somebody dey kom afta mi. I nor rish to remove shoe from en leg!’ 26 So my brodas, wey bi Abraham shidren and una wey bi Gentile pipol wey dey fear God, na di message about how God go take save pipol, naim wi kom tell una so. 27 Bikos di pipol wey dey stay for Jerusalem and all di rulers nor know am, so dem kon use wetin dem dey read for Sabat Day, wey di profets tok, take kill-am. 28 Even doh dem nor si anytin wey go make dem kondemn am, dem still tell Pilate make e kill-am. 29 Wen dem don do evritin wey Bible tok about am, dem bring am down from di cross kon put am for grave. 30 But God raiz am from deat 31 and for many days, e appear to di pipol wey dey follow am from Galilee go rish Jerusalem. Na dis pipol kon dey bear witness sey, dis tins na true. 32 And wi dey tell una di Good News about dis tins wey God promise awa grand-grand papa dem. 33 E don do wetin E promise us and dia shidren, wen E raiz Jesus Christ, as dem rite am for Psalms sey, ‘Yu bi my Pikin and today, I don bi yor Papa.’ 34 But bikos E don raiz Jesus Christ from deat make e nor for rotin, God kon sey: ‘I go give yu di holy promise wey una fit trust, wey I promise David.’ 35 E still tok for anoda Psalms sey, ‘Yu nor go allow yor Pikin wey dey holy, make e rotin.’ 36 Bikos David, afta e don do wetin God send am kon do among en pipol, e kon die and dem beri am with en grand-grand papa dem and e rotin, 37 but di pesin wey God raiz-up, nor rotin. 38 So my pipol, make una know sey, na thru dis Pesin wi dey prish sey, ‘God go forgive una.’ 39 True am, evribody wey bilive, go dey free from evritin wey Moses Law nor fit free dem from. 40 So make una make sure sey wetin di profets tok for groun, nor happen to una:
41 “ ‘Una wey dey laf;
make una hear, una go sopraiz till una die!
Bikos I go do sometin for una time,
sometin wey una nor go bilive even if dem tell una.’ ”
42 As Paul and Banabas dey komot, di pipol kon dey beg dem make dem still kon tok about all dis tins for di next Sabat Day. 43 Wen di meetin for di sinagog don finish, many Jew and Gentile pipol wey dey fear God kon follow Paul and Banabas, dey enkourage dem sey, make dem kontinue for di grace wey God give dem.
44 Di next Sabat Day, nearly evribody for di town gada make dem for hear God word. 45 But wen di Jew pipol si as di pipol plenty rish, jealousy kon full dia mind, so dem start to oppoz wetin Paul dey tok kon dey curse am. 46 Paul and Banabas kon use boldness take ansa dem, “E good sey na una wi first prish God word give. But since una rijet am and una nor ready to get life wey nor dey end, wi go-go prish give Gentile pipol. 47 Bikos dis na wetin God don already kommand us sey: ‘I don choose una to bi lite for Gentile pipol, make una bring salvashon kom dis world.’ ” 48 Wen di Gentile pipol hear wetin e tok, dem start to happy kon dey tank God for en word and evribody wey God don choose to get life wey nor dey end, kon bilive. 49 So God word kon dey spread round di whole kountry. 50 But di Jew pipol tok bad tins about Paul and Banabas give all di big wimen wey dey fear God and di big-big men for di town, so dem sofa dem and drive dem komot from di aria. 51 So wen dem don shake di land san-san wey dey dia leg komot, dem kon go Ikonium. 52 So di disciples kon dey happy and di Holy Spirit full dia life.