12
Dem Kill James And Put Pita For Prison
For dat time, King Herod katch some pipol wey dey go church kon sey e go kill dem. E kill James, wey bi John broda, with swod. Wen e si sey di Jew pipol happy with wetin e do, e kon arrest Pita too. (Dis tin happen for di time wey dem dey do di bread wey nor get yist feast.) Wen e don katch Pita put for prison, e put four gangs, wey get four four soldiers each, make dem guide am. Herod plan na to bring Pita out make e judge am for di whole town front wen Passova don finish. So as Pita dey prison, di pipol wey dey di church dey pray to God for am, day and nite. But for di nite before dem go judge am, dem tie Pita with two shains and e sleep for two sojas centre. Oda sojas still dey di prison front, dey guide am. God angel appear and lite kon shine for di prison. Di angel wake Pita kon tell am, “Get up kwik-kwik!” At wons, di shains fall komot from Pita hand. Di angel sey, “Wear yor klot and yor sandal.” So Pita do wetin di angel tell am. Den di angel sey, “Wear yor koat make yu follow mi.” Pita follow am go outside. Even doh e bilive sey wetin dey happen so na true, e tink sey na dream e dey dream. 10 Afta, en and di angel kon pass di first and di sekond sojas group, den dem kon rish di iron gate wey go di town. Di gate open by ensef and dem go outside kon waka pass one small street, den di angel leave am for der. 11 Wen Pita si sey all dis tins wey dey happen nor bi dream, e kon sey, “Naw I know sey, True-true, God send en angel kon save mi from Herod hand and from all di tins wey di Jew pipol tink sey go happen.”
12 Wen Pita eye don klear, e kon waka face Mary house wey bi John Mark mama, where many pipol gada dey pray for am. 13 Wen e nok di door, Rhoda, one savant girl, kon ansa. 14 Wen di girl hear Pita vois, e kon dey happy sotey e nor remember to open di door, but e run go tell dem sey Pita dey for outside. 15 Dem ansa di girl, “Yu nor know wetin yu dey tok!” But di girl still dey sey na Pita, so dem kon sey, “E go bi en spirit!” 16 But Pita still dey nok and wen dem open di door si am, dem kon sopraiz. 17 E use en hand take tell dem make dem kwayet and e kon tell dem how God take free am from prison. E tell dem, “Make una tell James and all di brodas dis story,” den e leave dem kon go anoda place.
18 Wen day break, di sojas wey dey guide Pita sopraiz well-well and fear katch dem wen dem nor si am again. 19 Wen Herod send pipol go find am and dem nor si am, e kweshon di sojas wey dey guide Pita kon kommand sey make dem kill all of dem. Den Herod komot from Judea go Caesaria go stay.
How Herod Die
20 Herod kon dey vex well-well for Tyre and Sidon pipol. So dem gada go si am. But dem kon first beg Blastus wey bi di king offisa, make e help dem beg am, bikos na di king kountry dey supply food give dia kountry. 21 Wen di day wey dem gri to meet am don rish, Herod kon wear en king dress and e kon sidan for en throne dey follow dem tok. 22 But as e dey tok, di pipol wey gada kon dey shaut, “Na god dey tok so-o, nor bi man!” 23 At wons God angel kon nak Herod fall for groun, bikos e nor give God glory and plenty worm kon chop en body till e die. 24 But God word kontinue to dey spread.
25 Banabas and Saul kon go back to Jerusalem wen dem don finish dia work and dem take John Mark follow body.