13
God Go Klean Judah 
 
1 God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.  
2 For dat day, I go remove all di juju name from di land and nobody go remember dem again. I go kill anybody wey klaim sey en na profet, den pipol mind nor go dey to go woship or serve juju again.  
3 But if anybody still get di mind to lie sey e dey profesai, na en own papa and mama go tell am sey, ‘Na deat go bi yor own, bikos yu dey lie with God name.’ Den if e still profesai, en papa and mama go shuk am die with swod.   
4 “For dat day, no profet go fit karry body up, bikos of en vishon. Nobody go sey en na profet or wear profet garment kon dey deceive pipol.  
5 Instead, e go sey, ‘I nor bi profet. Na farmer work I dey do since my mama born mi.’  
6 Den if pesin ask am, ‘So na who wound yu for yor chest?’ E go ansa, ‘Na my friend house I for wound.’ ”   
Di Sheep Dem Skata 
 
7 God wey dey mighty sey,  
“Swod! Make yu go attack and kill  
di shepad wey dey work for mi,  
den all di sheep go skata.  
I go attack my pipol   
8 and if dem divide all di pipol  
wey dey di land into three,  
two part go die finish.   
9 I go test di third part wey survive kon klean dem,  
just as dem dey klean silva for fire.  
I go test dem, just as dem dey test gold.  
Den dem go pray give mi and I go ansa dem.  
I go tell dem sey dem bi my pipol  
and dem go sey,  
‘Na di Oga bi awa God.’ ”