3
Leaders For Church
Dis na true word: If any man like to bi leader, na betta work e wont. Leader for church must bi pesin wey nor get fault; wey get only one wife; fit kontrol ensef; get sense and respet; dey welkom pipol and e bi good tisha. Make e nor bi drunkard or pesin wey like to fight; but e must dey gentol. Make e nor bi pesin wey like to kworel or love money. E must bi pesin wey dey manage en own house well and dey make en shidren obey and respet am. If pesin nor fit manage en own house, na how e go take manage God church? Who won bi leader must bi pesin wey get strong faith, bikos if e nor strong for faith, e go start to karry body up, den Satan go ponish am. Pipol wey nor dey di church must dey tok good about di pesin wey bi leader, so dat dem nor go disgrace and make am fall enter devil trap.
Like dis too, deakons must bi pipol wey get good karata; nor bi pipol wey dey play wayo; dey drink anyhow or love money. Dem must bi pipol wey get mind and dey prish di trut about di faith wey God don show us. 10 Before dem go choose deakons, make dem test dem well-well. If dem pass di test, den dem fit serve as deakons.
11 Like dis too, dia wifes must get good karata, nor bi wifes wey dey lie or gossip, but dem must fit dey kontrol diasef and dey honest for evritin.
12 Deakons must dey faithful to en wife and must fit kontrol en shidren and evritin for en house. 13 Doz wey don serve well as deakons, pipol go respet dem well-well and di faith wey dem get for Christ, go dey strong.
Karata For Church
14 I dey rite all dis kommand to una naw, even doh I dey hope to kom si una soon, 15 so dat if I nor kwik kom, una go know how pipol suppose bihave for God church, wey bi di true pila and foundashon. 16 Wi know sey God ways dey great well-well:
Christ kom as human being;
di Spirit show sey e dey free;
angels si am
wen e kom prish among Gentile pipol;
pipol bilive am for di world
and God karry am go heaven with glory.