8
David Win En Enemies
Afta sometaim, King David attack Filistia pipol again, e win dem kon take dia land wey bi Meteg Ammah from dia hand.
E win Moab pipol too. E make dem liedan for groun kon divide dem group by group and for evry three group, e kill two. So Moab pipol kon dey work and pay dia tax give David.
David still win King Hadadeza wey Rehob bi en papa, wey dey rule Siria for Zobah wen King Hadadeza dey go take-ova Uppa Eufrates for di river aria. David seize 1,000 seven hundred horse-men and 20,000 sojas wey dey waka for groun. E keep like one hundred horse kon cripple di rest.
Wen Siria pipol for Damaskus send sojas go help Hadadeza, David attack and kill 22,000 of dem. Den e build soja kamp for dia aria and dem kon dey pay dia tax to am. God make David win for evriwhere.
Di gold shield wey Hadadeza take dey guide ensef, David karry am go Jerusalem. E still take plenty bronze from Tebah and Berotai towns wey Hadadeza dey rule.
King Toi for Hamat hear sey David don defeat Hadadeza sojas. 10 So e send Joram en pikin make e go kongratulate David for en viktory against Hadadeza wey King Toi don fight many times.
11 David dedikate di silva and gold wey e bring from di nashons wey e win and dem use dem take serve God. 12 E win Edom, Moab, Ammon, Filistia and Amalek pipol and e still karry tins from Hadadeza.
13 David kon popula well-well afta e just kom back from where e for go kill 18,000 Edom pipol for Salt Valley.
14 E build soja kamp for evriwhere for Edom and di pipol for der kon dey under en pawa. God make David win for evriwhere.
15 David rule evriwhere for Israel and e make sure sey dem trit evribody well with betta mind. 16 Joab wey en mama name na Zeruaya, naim dey kommand di sojas, while Jehoshafat wey bi Ahilud pikin, dey keep rekord. 17 Zadok wey bi Ahitub pikin and Ahimelek wey bi Abiatar pikin, na dem bi priests. Na Seraya bi di kourt seketry. 18 Benaya wey bi Jehoiada pikin, naim bi David bodyguard oga. David sons na priests too.