4
Dem Kill Ish-Boshet
Wen Saul pikin, Ish-Boshet hear sey dem don kill Abner for Hebron, fear katch am well-well and dem kon tell evribody for Israel. Ish-Boshet get two ofisas; Baanah and Rekab wey bi leaders for war and dia papa na Rimmon from Beerot wey dey Benjamin tribe. Di pipol wey get dat land don run go Gittaim and dem don dey stay der since.
Mefiboshet wey bi Jonatan pikin and Saul grand-pikin, na five years e bi wen di news kom from Jezrel sey dem don kill en grand-papa Saul and Jonatan en papa for war. Den en nurse kon karry am dey run, but bikos e dey hurry, di pikin fall from en hand, so en leg kon break.
Rekab and Baanah go Ish-Boshet house for aftanoon wen e dey rest. Di pesin wey dey di door don sleep go as e dey pick dirty komot for wheat, so Rekab and Baanah kon waka small-small enter di house.
At wons, dem enter Ish-Boshet room kon kill-am. Den dem kut en head, karry follow body kon waka for nite pass Jordan River Valley. Dem give di head to David for Hebron kon sey, “Ish-Boshet wey bi Saul pikin; yor enemy wey won kill yu, na en head bi dis. Today, God don allow di king revensh Saul and en shidren-shidren.”
David kon ansa dem, “As long as di God wey save mi from all danger dey alive, 10 even di messenja wey kom meet and tell mi for Ziklag sey Saul don die tink sey e dey bring good news kom give mi. I whole and I kill-am. Dat na di reward wey I gi-am for en good news! 11 Not to tok about una wey do evil kon go kill pesin wey dey sleep for en own house! I go take revensh and as una kill-am, na so una go take die too!”
12 Den David orda en sojas and dem kill dem. Dem kut dia hand and leg komot kon hang dem near Hebron wotaside. But dem take Ish-Boshet head kon go beri am for Abner grave for Hebron.