24
David Kount Di Pipol
God kon dey vex for Israel pipol again and E make David bring trobol kom meet dem. God tell am, “Make yu go kount Israel and Judah pipol.”
So David orda Joab wey bi di sojas oga, “Make yu go round Israel tribe with yor ofisas; from one end to anoda for di kountry kon kount di pipol. I won know how dem plenty rish.”
But Joab ansa di king, “My king, make di Oga wey bi yor God make dem plenty hundred times pass as dem bi naw and yu go leave long kon si wen E go do am, but wetin make di king won kount di pipol?”
But di king make Joab and en ofisas obey en kommand, den dem komot go kount Israel pipol.
Dem cross Jordan River go kamp for di sout-side for Aroer land, di town for di valley wey dey Gad aria centre. From der, dem go di nort side for Jazer and from der, dem kon go Gilead and Kadesh for Het aria. Den dem go Dan and from Dan, dem kon go west for Sidon side. Dem go di sout-side for Tyre town wey dem fence kon rish all Hiv and Kanaan pipol town and dem stop for Beersheba for Judah sout.
So wen dem don waka for nine monts and twenty days, dem kon kom back to Jerusalem, bikos dem don travel round di kountry.
Dem tell di king about all di men wey fit do soja work and dem bi 800,000 from Israel and 500,000 from Judah.
10 But wen David don kount di pipol finish, en heart kon dey judge am, den e tell God, “I don kommit big sin for dis tin wey I do! Abeg, make Yu forgive mi. Na foolish tin I do so.”
11 Den God tell Gad wey bi David profet, “Go tell David sey I dey gi-am three tins and make e choose one of dem 12 and I go do anytin wey e choose.”
Wen David wake-up di next day, 13 Gad go meet and tell am wetin God tok, so e kon ask, “Wish one yu wont make God do? Three years wey honga go dey di land; three monts wey una go take run from una enemies or three days wey bad sickness go dey yor land? Naw, make yu tink am kon tell mi di ansa wey I go-go give God.”
14 David ansa, “I dey for bad kondishon, but I nor wont make men ponish mi, instead make only God ponish us, bikos E get mesi.”
15 So God kon send bad sickness kom Israel, wey last from dat morning go rish di time wey E choose. From one end go rish di oda end for di kountry, na 70,000 pipol die for Israel. 16 Wen Oga God angel won distroy Jerusalem, God kon shange en mind sey E nor go ponish di pipol again, so E tell di angel wey dey kill dem, “Make yu stop! E don do!” Dat time, di angel dey Araunah wey bi Jebus pesin farm.
17 David si di angel wey dey kill di pipol and e tell God, “Na mi dey guilty, na mi bi di pesin wey do wrong. Wetin dis poor pipol do? Make yu ponish mi and my family.”
18 Dat day, Profet Gad go meet David kon tell am, “Make yu go Araunah farm kon build altar for der for di Oga yor God.” 19 David obey and e do evritin wey Profet Gad tell am. 20 Wen Araunah look kon si di king and en ofisas dey kom meet am, e liedan for groun for David front 21 kon ask, “My king, why yu kom here?”
David ansa, “I kom buy yor farm make I for build altar put for God, so dat di sickness go stop.”
22 But Araunah ansa, “My king, make yu take am! Make yu use am do anytin wey yu like kon burn dis melu give God for di altar. Make yu use dia yoke and dis firewood for di ofrin.” 23 Araunah give di king evritin kon sey, “Make di Oga wey bi yor God asept yor ofrin.”
24 But di king ansa, “No! I nor go fit give di Oga my God, sakrifice wey I nor pay anytin for.”
So e buy di farm and di melu for fifty silva koins. 25 Den e build altar for der kon give God burnt and fellowship ofrin. So God ansa en prayer and di sickness for Israel kon stop.