16
David And Ziba
Wen David don pass di hill small, e kon si Ziba wey bi Mefiboshet savant. E bring some donkey wey karry two hundred bread and some kake; one hundred fresh fruit and one leda bag wey wine full.
David ask am, “Wetin yu won use all dis tin do?”
Ziba ansa, “Di donkey na for my king, David family, di bread and di fruit na for di men to chop and na di wine dem go drink wen dem don taya for di wildaness.”
Di king ask am, “Where Mefiboshet, yor masta, Saul grand-pikin?”
Ziba ansa, “E dey for Jerusalem, bikos dem tell am sey Israel pipol go gi-am en grand-papa Saul, kingdom back.”
Di king tell Ziba, “Evritin wey Mefiboshet get, don turn yor own.”
Ziba ansa, “I go always bi yor savant! Make I always dey do wetin dey good for my king eyes!”
David And Shimei
Wen David rish Bahurim, one Saul relashon wey dem dey koll Shimei wey bi Gera pikin kom out bigin curse David. Shimei start to stone David, en ofisas and en bodyguards. Shimei curse am dey sey, “Make yu get out! I sey make yu dey go! Yu wey kill pipol! Wiked man! Yu take Saul kingdom and naw, God dey ponish yu for all di pipol wey yu kill for Saul family. God don give di kingdom to Absalom yor pikin. Yu don fall; yu wey dey kill pipol anyhow!”
Abishai wey en mama name bi Zeruaya kon tell di king, “My king, why yu dey let dis dog curse yu? Make I go der go kut en head komot!”
10 But di king tell Abishai and Joab en broda, “E nor koncern una. If e curse mi, bikos God tell am make e curse mi, who get di pawa to ask am why e dey curse mi?”
11 David tell Abishai and all en ofisas, “My own pikin one kill mi, so why una dey sopraiz for dis man wey kom from Benjamin tribe? Na God tell am make e curse mi, so make una leave am make e dey curse. 12 May bi God go si my sorrow and E go give mi some blessing wey go remove dis curse.”
13 As David and en men dey waka pass, Shimei still follow dem rish di hill and e dey curse, dey trow stones and dirty for dia body. 14 Di king and all en men taya well-well wen dem rish Jordan River, so dem kon rest for der.
Absalom For Jerusalem
15 Absalom and Israel pipol enter Jerusalem and Ahitofel dey with dem. 16 Wen Hushai, David friend wey e trust well-well si Absalom, e kon shaut, “Di king go live forever! Di king go rule us tey well-well!”
17 Absalom kon ask am. “Wetin happen wey make yu nor dey loyal to yor friend David again? Why yu nor follow am go?”
18 Hushai ansa, “How I go follow am, I dey follow di one wey God choose for Israel pipol. I go stay with yu. 19 Even sef, na who I go serve, if nor bi my oga pikin? As I serve yor papa, na so I go take serve yu naw.” 20 Den Absalom tell Ahitofel, “Naw wey wi don dey here, wetin yu advise make wi do?”
21 Ahitofel ansa, “Go sleep with yor papa girl-friends wey e leave for di palis. Den evribody for Israel go know sey yor papa hate yu and doz wey dey follow yu, go kon get heart.” 22 So dem set one tent for di palis roof for Absalom and for evribody present, Absalom enter kon sleep with en papa girl-friends.
23 Dat time, any advise wey Ahitofel give, David and Absalom dey do as e tok, bikos dem bilive sey God dey tok thru am.