12
Natan Message
God send Profet Natan go tell David, “E get two men wey dey stay for di same town; one get money and di oda one poor. Di rish man get many melu and sheep and di poor man get only one sheep wey e buy. E dey kare for am and di sheep grow for en house with en shidren. E dey gi-am wetin e dey chop; di sheep dey drink wota with di man cup kon sidan for di man leg. Di sheep bi like pikin to am.
“But one day, di rish man get visitor for en house. E nor won kill en own animal take kook for di visitor, instead e go take di poor man sheep take kook for dem.”
David vex for di rish man well-well kon sey, “I swear with God name, di man wey do dis tin, must die! E must pay four times for di wiked tin wey e do.”
So Natan tell David, “Na yu bi di man and dis na wetin di Oga wey bi Israel pipol God tok. I make yu king for Israel and I save yu from Saul. I give yu en wifes and kingdom; I make yu king for Judah and Israel. If dem nor rish for yu, I for still give yu many oda tins. Wetin kon make yu disobey my kommand? Why yu do dis wiked tin? Yu kill Uriaya for war; yu allow Ammon sojas kill-am, den yu kon take en wife! 10 Naw, for evry generashon, yor shidren-shidren go die anyhow, bikos yu nor obey mi kon take Uriaya wife.
11 “I swear sey I go make somebody for yor family bring trobol kom give yu. Yu go si am wen I go kollect yor wife from yu kon gi-am to anoda man and e go sleep with dem for publik. 12 Yu sin for sekret, but I go make dis tin happen for publik make all Israel pipol si am.”
13 So David sey, “I don sin against God.”
Natan ansa, “God don forgive yu, so yu nor go die. 14 But bikos yu show God sey yu dey sorry for wetin yu do, yor pikin go die.” Den Natan kon go en house.
David Pikin Die
15 God kon make di pikin wey Uriaya wife born for David sick well-well. 16 David pray to God make di pikin well. E nor gri chop anytin and evry nite, e go enter en room liedan for groun. 17 En ofisas for house go meet am make e for stand up, but e nor gri or chop anytin with dem.
18 Afta one week, di pikin kon die and fear nor let David ofisas tell am di news. Dem sey, “Wen di pikin dey life, David nor dey ansa us wen wi tok to am, na how wi go take tell am sey di pikin don die? E fit go wound ensef o-o!”
19 Wen David si sey dem dey tok to diasef, e kon feel sey di pikin don die. So e ask dem, “Di pikin don die?”
Dem ansa, “Yes! E don die.”
20 So David stand up go baf; e komb en hair kon shange en klot. Den e go woship for God house. Wen e rish di palis, e ask for food and e chop am as dem just bring am.
21 En ofisas tell am, “Wi nor undastand dis tin! Wen di pikin dey live, yu kry for am and yu nor gri chop, but as e just die, yu get up go chop!”
22 David ansa, “Yes! I kry and fast wen e still dey live. I tink sey God go forgive mi, so dat di pikin nor go die. 23 But naw wen e don die, why I go dey fast? I go-go where e dey one day, but e nor fit kom meet mi for here again.”
Dem Born Solomon
24 Den David konfort Batsheba en wife. E sleep with am again and e born boy and David koll am Solomon. God love di pikin 25 and E kommand Profet Natan make e koll am Jedidaya, bikos God love am.
David Win Rabbah
26 Joab still kontinue en fight against Rabbah wey bi di kapital town for Ammon and e don dey win am. 27 E send messenjas go meet David sey: “I don attack Rabbah and I don take-ova where en wota dey kom from. 28 Naw, make yu gada yor oda sojas kon attack di towns, den take am by yorsef. I nor wont make anybody praiz mi sey na mi win am.”
29 So David gada en sojas go attack Rabbah and e win am. 30 David take gold crown from Ammon pipol juju wey bi “God Milkom” and di gold heavy rish seventy-five pound and jewel dey inside am too. David take am kon wear am for en own head. E still karry many tins from di town. 31 David use di town pipol take work well-well with saw, iron hoes and axe, den e force dem make bricks. Na so e do give di pipol wey dey di oda towns for Ammon. Den en and en men kon go back to Jerusalem.