10
David Win Ammon Pipol
Afta sometaim, King Nahash for Ammon kon die and en pikin, Hanun kon bi king. King David sey, “I must go pay respet and make friend with Hanun, as Nahash wey bi en papa do to mi.” So David send messenjas go tell am, “Sorry!” Dis na bikos of en papa wey die.
Wen dem rish King Hanun palis for Ammon, doz wey bi leaders for Ammon kon tell di king, “Yu tink sey na bikos of yor papa wey die naim make David send dis pipol kom? Wi bilive sey e send dem kom spy di land, so dat e go kom fight and win us leta!” So, King Hanun seize David messenjas kon kut dia hair and klot, den e send dem go back.
Shame nor let di men go back to dia house. Wen David hear wetin happen, e send message go meet dem sey make dem stay Jeriko till dia hair go grow again.
Wen Ammon pipol si sey dem don make David vex for dem, dem kon go Aram Bet-Rehob and Aram Zobah go hire 20,000 sojas wey dey waka for groun, plus 1,000 men from Maaka king and 12,000 men from Tob.
Wen David hear wetin dey happen, e kon send Joab with all en sojas go fight dem.
Ammon sojas mash go pozishon for where dem dey pass enter Rabbah, wey bi dia kapital town and di kings wey kom help dem, pozishon put for di open field. Wen Joab si sey dia enemy sojas go attack dem from front and back, e choose Israel sojas wey strong kon make dem face Siria sojas. 10 E kon sey make Abishai en broda dey kommand di oda sojas for di oda side wey face Ammon sojas. 11 Joab tell am, “If yu si sey Siria sojas dey opress mi, make yu kom help mi and if Ammon sojas dey opress yu I go kom help yu.
12 “Make yu get heart and dey strong! Make wi fight well for awa pipol and for God towns and make God do wetin dey en mind.” 13 Wen Joab with en sojas attack, Siria sojas kon bigin run.
14 So as Ammon sojas si sey Siria sojas dey run, dem too kon bigin run from Abishai enter di town. Den Joab kon go back to Jerusalem. 15 Siria pipol si as Israel pipol win dem, so dem kon go gada demsef again. 16 Hadadeza kon send for more Siria sojas wey dey di east side for Eufrates River and dem sey make Shobak wey dey kommand Hadadeza sojas for Zobah bi dia kommander.
17 Wen David hear wetin dey happen, e kon gada all Israel sojas, cross Jordan River kon put dem for di side wey face Siria, den di war kon start. 18 Israel sojas kon porshu Siria sojas go back. David with en men kill 7,000 war horse-men and 40,000 sojas wey dey waka with leg. Dem still kill Shobak wey dey kommand Siria sojas. 19 Wen di kings wey dey follow Hadadeza si sey Israel sojas don win dem well-well, dem kon go make peace with David and dey obey am.
So, Siria pipol nor gri help Ammon pipol again.