11
God Nor Rijet En Pipol
I dey ask, God don rijet Israel, en pipol? No! Mi too, na Israel pesin, I bi Abraham pikin wey kom from Benjamin tribe. God nor rijet en pipol wey E choose from di biginnin. Dem rite for God word about how Elijah beg God for Israel pipol sey, “Oga God, dem don kill all yor profets. Dem don skata yor altar, na only mi remain and dem dey try to kill mi too!” Na wish ansa God gi-am? E tell am, “I still get 7,000 men wey neva woship Baal juju at-all.”
Na so e bi naw too, some Israel pipol still dey woship God bikos of en grace. If na by grace God choose dem, dat mean sey, nor bi by pesin pawa: Bikos if na by pesin pawa, den grace nor mean anytin again. Dis mean sey, na only few pipol for Israel fit get wetin all of dem dey find. Di rest nor gri listin to God, bikos of dia sturbones, just as God word sey:
“God make dem foolish
sotey dia eye nor dey si
and dia ear nor dey hear till today.”
But David sey:
“Make di food wey dem dey chop,
kause trobol for dem
kon fall like stone for dia head
and make God ponish dem.
10 Make dia eye blind,
so dat dem nor go fit si.
Make wahala bend dia back forever.”
11 I dey ask again, Israel pipol wey fall nor go get up again? No! But bikos of dia sins, Gentile pipol don get salvashon and dis tin, dey make Israel pipol jealous. 12 If Israel pipol sin fit make Gentile pipol dey save, dat mean sey, wen Israel pipol turn go meet God, pipol wey go dey save, go plenty well-well.
13 Naw, I dey tok to una wey bi Gentile pipol and as long as I bi una apostle, I dey happy with di work wey I dey do, 14 so dat my pipol go dey jealous, bikos of wetin God dey do for Gentile pipol. Dis go make dem turn from sin kom meet God and E go save dem. 15 Bikos wen God rijet Israel pipol, di whole world kon get salvashon. Na how e go kon bi, wen God asept dem back? E go give life to pipol wey won die. 16 If dem give God di first part for bread, den na God get all di bread and if dem give God tree rut, den di whole tree don bi en own too.
17 Gentile pipol, una bi like branches wey dem add join olive tree. Una don take di place for some branches wey God first kut komot. So una dey enjoy di blessings, wey di rut dey give. 18 So make una nor boast, but make una remember sey, nor bi una dey make di rut stand, but na di rut dey support una. 19 So una go sey, “God break di branches komot, make E for fit si place wey E go put us.” 20 True-true, God break Israel pipol komot from di tree, bikos dem nor bilive am. But una dey where una dey, bikos una get faith. So, make una nor dey boast, instead, make una dey fear wetin God fit do. 21 If God nor sorry for Israel pipol wey bi di natural branches, una tink sey E go sorry for una if una sin? 22 Naw, una don si how God dey good and harsh. Even doh E dey vex for doz wey fall, E still dey kind to una. And E go always dey kind to una, as long as una dey do wetin E wont. If not, E go rijet una too. 23 If Israel pipol turn back kon meet God, E go put dem back for di tree, bikos E get pawa to do am. 24 Una wey bi Gentile pipol bi like olive tree branches wey dem kut for bush kon go put for anoda betta olive tree (and e nor suppose bi like dat). Na Jew pipol bi di betta olive tree; so e go eazy for God to join dem back to di original tree again.
25 My friends, I nor won make una dey boast about unasef. So I go tell una wetin happen to Israel pipol. Some among dem sturbon well-well and na so dem go bi until di nomba for Gentile pipol wey God wont, don komplete. 26 Na so God go save all Israel pipol just as en word sey:
“Di pesin wey go save Israel pipol
go kom from Zion,
den Jakob shidren nor go dey do bad tins again.
27 And na dis go bi my agriment with dem
wen I don forgive dem dia sins.”
28 As e bi sey Jew pipol rijet God word, dem don turn to God enemy, bikos of una wey bi Gentile pipol. But as God wont am, dem bi pipol wey E love, bikos of dia grand-grand papa dem. 29 God nor dey take back wetin e don already give pipol or shange en mind about di pipol wey E don choose. 30 As for una wey bi Gentile pipol, una don disobey God before, but naw, God don sorry for una, bikos Jew pipol nor gri obey am. 31 Bikos God don sorry for una, E go still sorry for dem too. 32 God trit evribody as prisonas, bikos wi nor gri do wetin E tell us. But E do am like dat, so dat E go fit sorry for all of us.
33 Who fit know how God big rish? Who fit know how God wisdom and undastandin bi? Who fit esplain why God dey do wetin E dey do!
34 Na who know wetin dey God mind?
Who go fit advise God?
35 Wish pesin don borrow God sometin
kon sey God go pay am back?
36 Bikos na God kreate evritin and na thru am evritin dey. Make praiz bi en own forever and ever! Amen.