27
Di Sojas Oga God
Dis na di list of leaders for Israel family and tribe with ofisas wey dey kommand sojas and all of dem get dia work for di kingdom. Dem sey make each group dey serve one mont for evry year and na 24,000 men dey each group.
Dis na di pipol wey dey kommand each group: di first group for di first mont na: Jashobeam wey bi Zabdiel pikin and dem bi 24,000 men. E kom from Perez family and na-im dey for di first mont.
For di sekond mont na: Dodai wey kom from Ahohi family (Na Miklot bi en main offisa) and dem bi 24,000 men.
Di third mont na: Benaya wey bi Priest Jehoiada pikin, dey lead dem and dem bi 24,000 men. Na Benaya bi di leader for di “Thirty.” Na en pikin, Amizabad bi en main offisa.
For di fourt mont: Asahel wey bi Joab broda, na-im dey lead dis group. (En pikin, Zebadaya kon take-ova from am) and dem bi 24,000 men.
Di fift mont na: Shamhut wey kom from Izhar family na-im dey lead am and dem bi 24,000 men.
Di sixt mont na: Ira wey Ikkesh wey kom from Tekoa, born and dem bi 24,000 men.
10 Di sevent mont na: Helez wey kom from Efraim tribe for Pelon and dem bi 24,000 men.
11 Di eight mont na: Sibbekai for Hushah and na from Zera family for Judah tribe, e from kom and dem bi 24,000 men.
12 Di ninet mont na: Abiezer from Anatot wey dey Benjamin tribe and dem bi 24,000 men.
13 Di tent mont na: Maharai from Netofat (na Zera family e from kom) and dem bi 24,000 men.
14 Di elevent mont na: Benaya from Piraton wey dey Efraim tribe and dem bi 24,000 men.
15 And di twelft mont na: Heldai from Netofat (e kom from Otniel family) and dem bi 24,000 men.
16 Di ofisas for Israel tribe na:
Zikri pikin Elieza and e dey lead Reuben tribe.
Shefataya wey Maaka born, dey lead Simeon tribe.
17 Na Kemuel pikin Hashabaya dey lead Levi pipol,
but na Zadok dey lead Aaron shidren-shidren.
18 Na King David broda Elihu dey lead Judah tribe,
while Omri wey Mikael born dey lead Issakar tribe.
19 Na Obadaya pikin Ishmaya dey lead Zebulun tribe,
while Jerimot wey Azriel born dey lead Naftali tribe.
20 Hoshea wey Azazaya born, na-im dey lead Efraim tribe,
while Joel wey bi Pedaaya pikin, dey lead West Manasseh.
21 Iddo wey bi Zekaraya pikin dey lead East Manasseh for Gilead;
Jaasiel wey Abner born dey lead Benjamin tribe,
22 while Jeroham pikin, Azarel dey lead Dan tribe.
23 Wen David sey make dem kount di pipol, e sey make dem nor kount pipol wey neva pass twenty years, bikos God promise sey E go make Israel pipol plenty like di stars wey dey di sky. 24 Joab wey en mama na Zeruaya kon bigin kount di pipol, but e nor komplete am. God kon ponish Israel for wetin dem do, so dem nor fit rite di real nomba for King David own book.
Doz Wey Keep Di King Propaty
25 Dis na di pipol wey keep di king propaty for en palis: For di royal store room, Azmavet wey Adiel born, dey der.
Na Jonatan wey Uzzaya born, dey di local store room. To dey do farm work na: 26 Ezri wey Kelub born, na-im dey der.
27 Na Shimei from Ramat dey di vineyard, while Zabdi from Shefam, dey di wine store.
28 Na Baal-Hanan from Geder dey keep di olive and sikamore trees (wey dey di west land for under di hills).
While Joash dey keep di olive oil.
29 Shitrai wey kom from Sharon, na-im dey keep di melu dem for where dem for dey chop grass for Sharon, while Shafat wey Adlai born, dey keep di animals wey dey di valley.
30 Na Obil wey kom from Ishmael tribe, dey keep di kamel; Jehdeaya from Meronot dey keep di donkeys, while 31 Jaziz wey kom from Hagrit, dey keep di sheep.
32 Jonatan wey bi David papa broda na betta advise and e know wetin e dey tok. Na en and Hakmoni pikin, Jehiel dey tish di king sons.
33 Na Ahitofel dey advise di king, while Hushai from Ark, na di king very good friend.
34 Jehoiada wey Abiatar born give Benaya, na-im kon take-ova from Ahitofel.
Na Joab bi di whole sojas oga.