25
Doz Wey Go Sing
King David and di ofisas pick some of Asaf, Heman and Jedutun shidren to profesai as dem dey play instrument and cymbals. Dis na di men wey dem choose:
From Asaf sons:
Zakkur, Josef, Netanaya and Asarelah. Asaf wey dey profesai for di king, na-im dey lead dem.
From Jedutun sons:
Gedalaya, Zeri, Jeshaaya, Shimei, Hashabaya and Mattitaya. Dia papa wey dey profesai wen dem dey praiz God, na-im dey lead dem.
From Heman sons:
Bukkaya, Matanaya, Uzziel, Shebuel, Jerimot, Hananaya, Hanani, Eliatah, Giddalti, Romamti-Ezer, Joshbekashah, Malloti, Hotir and Mahaziot. All dis na di king profet wey bi Heman shidren. God gi-am fourteen sons and three dotas, just as E promise am sey e go dey great.
Na dia papa dey lead dem and dem dey sing for God Temple, dey play cymbal and oda instrument as dem dey serve for der. But na di king dey supavise Asaf, Jedutun and Heman. Dem train dem and dia rilashons so dat dem go fit play music well for God and dem bi 288. Dem dey trow dice to take know di work wey dem go do, weda yu old or yong, weda yu sabi di work or just dey start am.
Di first dice wey dem trow na for Josef wey bi Asaf pikin and twelf of en sons and rilashons.
Di next one na Gedalaya and twelf of en sons and rilashons,
10 before Zakkur and twelf of en sons and rilashons.
11 Next pesin na Izri and twelf of en sons and rilashons.
12 Den Netanaya and twelf of en sons and rilashons.
13 Before Bukkaya and twelf of en sons and rilashons.
14 Di next na Jesharelah and twelf of en sons and rilashons.
15 Before Jeshaaya and twelf of en sons and rilashons.
16 Matanaya and twelf of en sons and rilashons.
17 Shimei and twelf of en sons and rilashons.
18 Azarel and twelf of en sons and rilashons.
19 Hashabaya and twelf of en sons and rilashons.
20 Shubael and twelf of en sons and rilashons.
21 Mattitaya and twelf of en sons and rilashons.
22 Jerimot and twelf of en sons and rilashons.
23 Hananaya and twelf of en sons and rilashons.
24 Joshbekashah and twelf of en sons and rilashons.
25 Hanani and twelf of en sons and rilashons.
26 Malloti and twelf of en sons and rilashons.
27 Eliatah and twelf of en sons and rilashons.
28 Hotir and twelf of en sons and rilashons.
29 Giddalti and twelf of en sons and rilashons.
30 Mahaziot and di twenty fourt dice, na for
31 Romamti-Ezer and twelf of en sons and rilashons.