14
David Build Palis For Jerusalem
King Hiram for Tyre kon send message go give David sey make dem do business togeda. E still send cedar wood, stones and karpenters make dem take build one palis for David. David know sey na God make am king for Israel and E dey prosper en kingdom and pipol.
David marry plenty wifes for Jerusalem and e born many shidren. Di shidren wey dem born for am for Jerusalem na: Shammua, Shobab, Natan, Solomon, Ibhar, Elishua, Elpelet, Nogah, Nefeg, Jafia, Elishamah, Beeliada and Elifelet.
David Win Filistia Pipol
Wen Filistia pipol hear sey dem don make David king for Israel, dia sojas gada won kon go fight am. But David hear dia plan, so en and en men kon mash go meet dem. Filistia pipol go skata evriwhere for Refah Valley. 10 So David ask God, “Make I go attack Filistia pipol? Yu go dey with mi?”
God ansa, “Yes! Go attack dem, bikos I go dey with yu!”
11 So David attack and win dem for Baal-Perazim. David kon sey, “My Oga God don use mi take distroy my enemies like wota wey dey rush fit force.” So E kon koll di place, “Baal-Perazim.” 12 Wen Filistia pipol dey run, dem leave dia juju, so David orda en pipol make dem burn dem trowey.
13 E nor too tey before Filistia pipol go skata di valley again. 14 Den David ask God again and E sey, “Nor attack dem from dis side, but go pass thru where di Balsam trees dey. 15 And wen yu hear pipol dey mash on-top di trees, make yu attack dem bikos, I go mash go yor front go distroy Filistia sojas.” 16 David kon do as God kommand, so e drive Filistia pipol from Gibeon pass Geza.
17 David story spread go evriwhere and God kon make all di nashons dey fear am.