12
David First Sojas
Dis na di men wey join David for Ziklag for di time wey e dey run from Saul wey bi Kish pikin and dis men dey among di sojas wey help am for war. Dem kom from Benjamin tribe and na der Saul from kom. Dem sabi shot arrows and trow stones well with dia two hand.
Na Ahiezer and Joash wey bi Shemaah shidren, wey kom from Gibeah, bi dia kommander. Di sojas na: Jeziel and Pelet wey Azmavet born; Berakah and Jehu wey kom from Anatot. Ishmaya wey kom from Gibeon and e popula well-well, bikos e dey join “Di Thirty.” Jeremaya, Jahaziel, Johanan and Jozabad wey kom from Gederah; Eluzai, Jerimot, Bealaya, Shemaraya and Shefataya wey kom from Haruf; Elkanah, Isshaya, Azarel, Joeza and Jashobeam wey kom from Korah family; Joelah and Zebadaya wey bi Jeroham shidren and dem kom from Gedor.
Some strong sojas for Gad wey dem don train for war kon go join David too. Dem dey karry shield and spear. Dem bi like wiked lion and dem dey run fast like deer wey dey di hill.
Na Ezer bi dia leader,
follow by Obadaya, Eliab,
10 Mishmannah, Jeremaya,
11 Attai, Eliel,
12 Johanan, Elzabad,
13 Jeremaya and Makbannai.
14 Some of dis men wey kom from Gad tribe na senior offisa wey dey kommand tazon pipol, while di odas dey kommand hundred. 15 For di first mont for di year, wen Jordan River dey flow enter land, dem kon cross go skata di pipol wey dey stay di valley, for di east and west side for di river.
16 Some from Benjamin and Judah tribe still go meet David. 17 David go meet dem kon sey, “If una kom like friends kon help mi, den I go make agriment with una! But if una kom sell mi give my enemies wen I nor tosh or wound una, make awa grand-grand papa God si evritin kon judge una.”
18 Den one spirit enter Amasai wey dey lead Di Thirty, so e kon sey,
“David, Jesse pikin,
wi dey yor side!
E go betta for yu!
E go betta for doz wey dey help yu!
True-true, yor God dey yor side!”
So David welkom dem kon make dem ofisas among en sojas.
Doz Wey Kom from Manasseh
19 Some from Manasseh tribe still go meet David wen e follow Filistia pipol go fight Saul. (But, e nor help di Filistia pipol, bikos dia king dey fear sey e go sell dem give Saul wey bi en oga before, so dem send David and en men go back to Ziklag.) 20 Wen David go Ziklag, Manasseh men wey join am na: Adnah, Jozabad, Jediael, Mikael, Jozabad, Elihu and Zilletai and na one-one tazon sojas dem dey lead. 21 Dem bi David ofisas, bikos dem bi strong sojas. Leta, dem kon bi ofisas among Israel sojas. 22 Na almost evriday new pipol dey kom join David sojas. So en and en sojas kon plenty well-well.
David For Hebron
23 Dis na di names of di strong sojas wey kom join David with dia leaders for Hebron, so dat David go bi king afta Saul, just as God tok am:
24 From Judah: na 6,800 sojas wey dem don train to karry shield and spear.
25 From Simeon: na 7,100 sojas.
26 From Levi: na 4,600 sojas. 27 Doz wey follow Jehoiada kom from Aaron family na: 3,700 with 28 Zadok wey sabi fight well-well and 22 oda leaders for di family.
29 From Benjamin wey bi Saul tribe: na 3,000 men wey dey loyal to Saul before.
30 From Efraim: na 20,800 popula men for dia village.
31 From half of Manasseh tribe: na 18,000 sojas wey dem sey make dem kon make David king.
32 From Issakar: na 200 leaders and dia family; dem undastand evritin, plus wetin Israel pipol suppose do.
33 From Zebulun: na 50,000 sojas wey karry difren weapon and dem dey ready for war.
34 From Naftali: na 1,000 ofisas with 37,000 sojas with dia shield and spear.
35 From Dan: na 28,600 sojas and dem dey ready for war.
36 From Asher: na 40,000 sojas and dem dey ready for war.
37 Doz wey kom from di oda side for Jordan River: From Reuben, Gad, and di half tribe for Manasseh: na 120,000 sojas wey karry difren weapon.
38 All dis men na sojas wey dey ready to fight. Dem kom Hebron kon make David king ova Israel pipol. In-short, evribody for Israel gri sey make David bi dia king. 39 Dem use three days take follow David chop and drink, bikos dia pipol give dem evritin wey dem wont. 40 Even dia neighbours; doz for nort wey dey far like: Issakar, Zebulun and Naftali tribe, still bring donkey, kamel and melu kon load dem with food, flour, fig, raisin, wine and olive oil. Dem still bring sheep, so dat di men go chop and Israel pipol kon dey happy more-more.