95
Praiz And Woship Song 
 
1 Kom make wi sing praiz God!  
Make wi shaut praiz di Rock wey dey save us.   
2 As wi dey kom meet am, make wi sing songs take tank am.  
Make wi sing psalms take praiz am.   
3 Di Oga na great God!  
Na great King wey pass evry oda god.   
4 Under di eart dey en hand  
and na-im get di mountins too.   
5 Na-im get di sea,  
bikos na-im make am and na en hand E take make di dry land too.   
6 Kom! Make wi go woship  
and bow to am.  
Make wi knee down  
before God wey make us,   
7 bikos na-im bi God.  
Wi bi en pipol and E dey wosh ova us,  
bikos na wi E dey kare for.   
8 God sey, “Make una nor sturbon as Israel pipol do  
wen dem dey Meribah and Massah  
wey dey di wildaness.   
9 Bikos for der, even doh dia grand-grand papa dem si evritin wey I do,  
dem still test and try my patient.   
10 So, I vex for dem for forty years kon sey,  
‘Dis pipol heart don turn from mi  
and dem nor gri do wetin I tell dem.’   
11 So I kon swear as I dey vex sey:  
‘Dem nor go ever enter my place where rest dey.’ ”